WTO D-G election: "Ngozi Okonjo-Iweala" dey list as "Director-General of World Trade Organization" election race eliminate Egypt, Mexico, Moldova

"Director-General of World Trade Organization election" candidates
Wetin we call dis foto, Di candidates for WTO Director-General
Published

Di World Trade Organisation don comot three candidates from Egypt, Mexico, Moldova wey bin dey compete for Director General of di organisation.

Di chair of WTO General Council Ambassador David Walker bin announce am on Friday, 18 September during one informal meeting of Heads of Delegation.

As e be so, Kenya, Nigeria, South Korea, UK and Saudi Arabia go continue to round two wey go start on Thursday 24th September to 6th October.

"Director-General of World Trade Organization election" candidates

Dis na di list of candidates for WTO director-general:

  • Mohammad Maziad Al-Tuwaijri - Saudi Arabia
  • Liam Fox - UK
  • Jesús Seade Kuri - Mexico
  • Abdel-Hamid Mamdouh - Egypt
  • Amina Mohamed - Kenya
  • Yoo Myung-hee - South Korea
  • Ngozi Okonjo-Iweala - Nigeria
  • Tudor Ulianovschi - Moldova