Liberia charge former vice president of drug-trafficking, money laundering and oda offences

Jewel Cianeh Taylor wears a blue lanyard and grey jacket, gold earring at an economic forum in Poland, 2021. She has shiny black hair.

Wia dis foto come from, NurPhoto via Getty Images

Wetin we call dis foto, Jewel Cianeh Taylor was Vice President of Liberia from 2018 to 2024
    • Author, Harry Sekulich
  • Published
  • Read am in 2 mins

Liberia don charge former vice president Jewel Howard-Taylor wit drug trafficking, money laundering and a range of oda offences, di kontri justice ministry confam.

Howard-Taylor, wey bin dey off office between 2018 and 2024, bin dey detained bifor she board flight at Roberts International Airport for di capital Monrovia.

She neva make any public comment about di charges.

Di West African kontri don launch major crackdown against di transnational drug trades in recent years, particularly cocaine trafficking.

Howard-Taylor chop accuse of illegally importing, selling and transporting controlled drugs, as well as helping to facilitate drug trafficking.

Police don charge three foreign nationals – two Croatians and one Ukrainian – in absentia as part of dia investigation. Dem chop accuse say dem be part of di same network as di former politician.

Howard-Taylor bin hold senior role in former president George Weah administration, wey im six years get repeated allegations of corruption and financial mismanagement.

Na President Joseph Boakai succeed am and e bin pledge to crack down on corruption and resist efforts from traffickers to set up bases for Liberia.

Drug pushers dey use West Africa as major transit route for cocaine trading from South America to Europe.

We dey update dis tori