Nigerian Army appoint General Officers Commanding for new Army divisions

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X
Di Nigeria Army don approve di appointment of General Officers Commanding (GOCs) to di newly established Army Divisions, as di military expand dia command structure to strengthen operations across di kontri.
Dis new appointments dey come afta President Bola Tinubu recently approve di creation of four additional Nigerian Army divisions as part of effort to strengthen di kontri security structure and improve how di military dey carry out dia operations.
Di Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Waidi Shaibu wey approve di appointments say di new formations go immediately commence operations for di respective locations, afta dem get di Initial Operational Capability, as dem go take deliberate measures to achieve Full Operational Capability (FOC).
Tok-tok pesin for di Nigerian Army Colonel Appolonia Anele announce dis informate for one statement on dia official X account on Wednesday, 29 July.
Na on 23 July, Presido Tinubu approve make Nigerian Army expand from eight divisions to 12 divisions.
Di military explain say dem design di new divisions to ensure "seamless operationalisation, operational continuity and rapid force projection across di kontri."
Di statement add say di Nigerian Army don undertake comprehensive reorganisation of dia Divisional Areas of Responsibility.
End of Di one wey oda users dey read well well
Under di new structure: di army chief say, 1 Division Kaduna go dey responsible for security for Kaduna, Kano, Katsina and Jigawa States, while 2 Division Ibadan go cover Oyo, Osun, Ekiti and Ondo States.
Di 3 Division Jos go oversee Plateau, Bauchi and Gombe States, while di newly established 5 Division go get dia headquarter for Makurdi and go assume responsibility for Benue, Nasarawa and Kogi States.
Di 6 Division Port Harcourt go cover Rivers, Akwa Ibom and Cross River States, while di 7 Division Maiduguri go dey responsible for Borno and Yobe states.
Di 8 Division Sokoto go retain responsibility for Sokoto, Kebbi and Zamfara States.
Furthermore, di newly established 9 Division, headquarter go dey for Ilorin. Dem go cover Kwara and Niger States, while di newly established 10 Division, headquarter go dey for Jalingo, and dem go dey responsible for security for di border areas of Taraba and Adamawa States.
Di 81 Division Lagos go continue to oversee Lagos and Ogun States, while 82 Division Enugu go retain responsibility for Enugu, Anambra, Abia, Ebonyi and Imo States.
Di newly established 83 Division, go get dia headquarter for Benin City, and dem go cover Edo, Delta and Bayelsa States wen dem activate am later in di year.
Who be di new GOC's and dia new post
To provide leadership for di new formations, Lieutenant General Shaibu approve di appointment of senior officers wey e tok say get operational experience.
Here na di names of di new GOCs:
Major General Yakubu Yahaya - new GOC for 9 Division Ilorin, e also be di commander of Operation Savanna Shield, di military operation to fight terrorist elements wey dey disturb for di North Central states of Kwara and Niger.
Major General Chinedu Ralph Nnebeife - new GOC 10 Division Jalingo.
E bin dey serve for di headquarters 2 Division/Sector 3 Joint Task Force (North West), Operation Fansan Yamma wey dey tackle bandits for di Sokoto and Zamfara axis of di Northwest region of Nigeria.
Major General Moses Gara - new GOC 5 Division Makurdi. E go also serve as di commander of di Joint Task Force Operation Whirl Stroke wey be di military operation combating insecurity for Benue State and di surrounding areas.
Major General Auwalu Mahmuda - new GOC2 Division, Ibadan. E bin dey ser for di Army Headquarters Directorate of Inspection and Compliance.
Three new brigades created
Also, di Nigeria army don create three new brigades to strengthen di new divisions wey dem create.
Din new brigades na:
11 Brigade Gboko (Benue State) wit di commander as Brigadier General A.O. Odubiyi, who bin dey serve for di Army Headquarters Operations Centre
29 Brigade Kainji (Niger State) wit di commander as Brigadier General AM Haruna.Oga Haruna bin dey serve for di Nigerian Army Armour School, Bauchi.
10 Brigade Lafia (Nasarawa State) wit di commander as Brigadier General R.M. Aminu who bin dey serve for di National Defence College, Abuja.
For di statement wey di army tok-tok pesin Appolonia Anene release on Wednesday, e tok say di new army divisions and brigades go "significantly enhance command and control, improve operational coordination and strengthen border security".
E go also "facilitate faster deployment of troops and resources and increase di Nigerian Army capacity to respond decisively to emerging and evolving security threats across di kontri".
On 23 July 2026, President Tinubu approved the creation of four new army divisions in the kontri, to bring di total to 12, as well as di recruitment of 28,000 additional army personnel.
Tinubu tok say di expansion na to demonstrate im administration commitment to continue investing for di Nigeria security infrastructure in terms of improvement for military hardware and equipment, beta welfare for di troops, and modernisation of di entire armed forces.
Dis efforts, according to di presidency, go help Nigeria to beta tackle di plenty security challenges wey dey face di kontri, and also make di military eva ready to defend Nigeria from internal and external aggression.














