Ecuador intelligence chief and five Americans die for Kenya helicopter crash

Rescue officials for di crash site for Samburu County

Wia dis foto come from, Kenya Red Cross/Handout via REUTERS

Wetin we call dis foto, Rescue officials for di crash site for Samburu County
Published
Read am in 2 mins

Ecuador intelligence chief and im wife don die for inside one helicopter crash wey happun for Kenya on Wednesday., 19 August.

Five Americans also die for di crash, one US State Department tok-tok pesin confam.

Michele Sensi-Contugi and im wife Stephany Hollihan dey among di seven wey die wen di accident happun for Samburu County at approximately 09:13 local time (06:13 GMT).

Kenya Civil Aviation Authority (KCAA) tok say di helicopter bin dey on scenic flight from one wildlife conservancy for Loisaba go Ewaso Nyiro, one river wey dey flow along several national reserves.

"Di National Government express dia most heartfelt condolences ova di sensitive passing of Michele Sensi-Contugi and im wife Stephany Hollihan," Ecuador presidential office tok for statement on X.

Former President of Ecuador Guillermo Lasso don pay tribute to di couple on social media, e say: "My solidarity and closeness to dia family members, friends, and colleagues for these moments of profound grief.

Di Kenya Red Cross tell BBC say dem no fit access di yet, but dem dey use drones to assess di area.

Di KCAA say di accident involve one Eurocopter EC130 B4 and dem dey coordinate operations.

Di transport ministry and Air Accident Investigations Department go lead "investigations into di circumstances wey surround di accident", dem add.

Samburu county na popular tourist destination wey get many private wildlife conservancies and e dey popular for dia stunning scenery.

Helicopter crashes dey common for Kenya.

For February, one helicopter crash for di Rift Valley County of Nandi wey kill pipo, plus one member of parliament.

For 2024, di military chief, Gen Francis Omondi Ogolla, die afta one army helicopter wey bin carry 11 pipo crash for di west of di country, wit only two survivors.

For June 2021 at least 10 sojas die wen dia helicopter crash as e dey land near di capital, Nairobi.