'She die di day we end our externship' - Wetin we know about death of 23-year-old law school student wey die for Lagos campus

Wia dis foto come from, Faith Alayande/Instagram
One close friend to di law student Faith Alayande wey authorities say fall from rooftop don describe di kain pesin wey she be bifor she die.
Tori wey dey trend be say di female law students bin jump from di top of a corridor for di Law School campus wey dey Lagos.
Her friend identify her as graduate of Alex Ekwueme Federal University Ndufu-Alike, Ebonyi State, and she dey undergo externship programme for one law firm for Lagos bifor she die.
Nigerian Law School bin confam di death of one of dia students, Faith Alayande wey die from fall from di hostel rooftop for Lagos Campus, according to statement from di school.
Alayande na student of di Enugu Campus, and she dey currently undergo externship programme for di Lagos Campus hostel wia she suppose
Inside one statement from di school management on Monday, dem tok say di mata happun around 4am on Friday, 7 August.
One veri close friend to di deceased say di incident shock her as she hear of di death of her friend becos she no first believe.
"I no believe say she jump from dat rooftop, maybe she mistakenly fall from dat place, I no wan tink am say she jump. We no see her as pesin wey go wan give up just like dat," she tok.
Wetin Nigerian Law School tok
According to di Nigerian Law school for dia statement, dem confam same Faith Alayande die sake of say she fall from rooftop of Lagos campus hostel.
Through di Director of Administration, Aderonke Osho, dem tok say dem dey work closely wit di appropriate authorities and di family to find out di circumstances wey surround di mata, and make sure say dem follow all necessary procedures.
"Preliminary information show say, about 4:00am on Friday, 7 August 2026, di student fall from di rooftop of di hostel wey dey di Campus, and sadly, e no survive di incident," di statement tok.
"Nigerian Law School dey deeply sad by dis tragic development. Di management dey work wit di appropriate authorities and di family to find out wetin happun and make sure say all necessary procedures dey duly followed, and provide further information as appropriate."
"Di management extend dia deepest condolences and sympathy to di family, colleagues and all di pipo wey di mata affect. Our thoughts and prayers dey wit di family for dis hard time," di statement tok.
'I no believe say she jump from dat rooftop'
Meanwhile, di BBC News Pidgin reach out to one of Faith close friends and university course mate.
Precious Onyinye na friend to Faith Alayande. Dem gada attend di same university and study same course.
Di news of Faith death hit Precious hard sotey she begin dey cry as she dey tok about di incident wey lead to di death of her long time friend.
"We dey veri close, we be group of five friends and she dey among. Wen we dey university, we dey always tok about our life, trips and academics," di friend tok.
She say Faith na like di brainbox among di group of friends and she dey veri lively evri time wey dem dey togeda.
According to Precious, she neva tok to Faith dat week wey di incident happun, as dem dey round off wit dia externship programme for dia different law firms.
She say na Enugu Faith dey bifor for her Law School bifor she come Lagos and di death come for di period wey dem suppose resume back to school.
Precious say her friends no see am say dat kain incident go happun.
In fact, she say wen di group of friends dey complain about life, na Precious go encourage dem say life dey sweet and 'make nobodi kpai imsef.'
"She no mention to us say she dey go through anytin, all of us dey do our externship for different states.
"I no believe say she jump from dat rooftop, maybe she mistakenly fall from dat place, I no wan tink am say she jump. We no see her as pesin wey go wan give up just like dat," Faith friend tok.
Precious describe her late friend as pesin wey be di life of di party. "She dey kind, she be good pesin, we know her and we dey tell her, she dey make evriwia lively."
Faith death tori dey come same time wey dem end dia externship and her friend say no be say she dey fear exams wey go make her take her own life.
"Di day she die na di day we finish our externship. E end week bifor so we get one week vacation, we suppose resume to school for di next day," Precious tell BBC News Pidgin.

Wia dis foto come from, @MarvinUchenna_/X
According to di school management, di family of di deceased go like to grieve privately and make di media and public allow dem mourn her death.
"In view of di heavy grief becos of dis unfortunate loss, di family don request respectfully make di public, members of di media and all di pipo concerned make dem allow dem enjoy dia privacy to mourn dia loss," di statement tok.
"Di Management of Nigerian Law School dey appeal to evribodi make dem follow di family wish and refrain from actions wey go worsen dia sorrow during dis hard time.
"Di Nigerian Law School remain committed to di safety, welfare and wellbeing of all dia students and staff," di statement add.









