You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'My son na easy-going pesin, no be troublemaker' - Papa of DG of alleged fake agency PFIPC
Di papa of Adeyemi Adeniyi, di Director-General of di alleged fake federal govment agency, Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), don cry out say e no know why police break into im house afta di allegations against im son.
Local media report say police arrest Adetunji for im home for Ogbomoso area of Oyo State.
Di papa follow BBC tok for im house on Tuesday, wia e narrate im ordeal for di hands of di police and wetin im know about im son accusation for Abuja.
E tok say dem question am bifor dem carry am go police station.
"Dem tear all di barbed wires wey we mount on di wall wey surround di house and break di fence and door of my house," Adeniyi tok.
Di papa show how police damage di entrance to di Adeniyi family compound. E say wen e confront dem, dem say dem be security pipo.
"I ask dem wia dem dey come from, and dem say dem be security officials," di papa add.
Di tori of Prince Adeniyi Adeyemi don gain national interest as President Bola Tinubu even order investigation into di mata as e also concern office of di Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila.
'My son work dey for Abuja, no be troublemaker' - Adetunji Adeniyi
Adetunji tell BBC say afta di police officers forcefully enta im family residence, dem begin search di entire house, including im laundry room and kitchen.
Adeniyi tok say dem leave im residence around 1pm but wen e reach about 2pm dem come back and take away di phones wey dey for di house and leave again.
"Wen e don reach about 11:00 a.m. di next morning, dem come again. I dey worry, I just dey say, 'Wetin be dis again, my God?' Dem wan kill me?"
E say wen dem ask am wetin im son dey do as work, e say e tell dem say im son dey work for Abuja.
"My son na easy-going pesin, no be troublemaker. All I know be say im tok say im dey work for Abuja. Na easy-going pesin since e dey small," e tok
"I dey veri sad as I dey hear all dis reports. I dey really confused by all dis. I go dey lie if I tok say I no dey confused."
Adetunji also tell BBC say im pikin bin dey home wit am for Ogbomoso from Tuesday, 30 June to Wednesday, 1 July.
"E come home about eight days ago, and leave di next day, e tok say im dey go back to Abuja," Adetunji tok.
"Dem (police) ask me how I no know wia my son dey live. I no tok say I no know wia e dey live. E dey live for Abuja. But wen e dey go work, I no fit go tell am say make e no go work?"
Adetunji say police ask am plenti questions but na di ones wey e sabi im tell dem.
Wetin happun bifor?
On Wednesday, 1 July, di tok-tok pesin to President Bola Tinubu, Bayo Onanuga, claim say di appointment of Adeniyi Adeyemi as di Director-General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council na fake as di president no make such appointment or create di office.
Adeniyi Adeyemi, claim say im appointment as di Director-General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council no be fake.
However, statement from Femi Gbajabiamila, di President Chief of Staff, tok say di Nigeria govment no get any office like dat and say President Tinubu no eva give any appointment to Adeyemi.
Onanuga inside im statement accuse Adeyemi say e use fake documents wit forged signatures and seals, to dey claim leadership appointment for office wey no dey in existence.
E also tok say police don chook eye for di mata and dem establish say di agency wey Adeyemi claim say e be di DG na fake, and say di man bin forge im appointment letter plus oda documents wey police recova from im house and office.
However, Adeyemi bin deny di allegation wey both Onanuga and Gbajabiamila dey put ontop im head.
For statement wey e release on 26 June, e claim say e get documents to show say true-true Presido Tinubu give am appointment.
Adeyemi say di Presidential Foreign Intervention Promotion Council wia e be Director-General get account wit di Central Bank of Nigeria (CBN), and di govment bin allocate money to dem for di 2026 budget.
Di president direct di commission make dem conclude dia investigation and submit report within 30 days.
President Tinubu say make di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) conduct investigation into di activities of di alleged fake agency and all mata wey dey related to am.
E say make ICPC conclude dia investigation and submit comprehensive report to am within 30 days.