Why US sanction Rwanda defence ministry ova DR Congo war

Published
Read am in 4 mins

United States don impose sanction on Rwanda defence ministry ova dia alleged support for M23 rebel group for eastern DR Congo.

Dis go increase di pressure on Kigali to pull out dia soldier and stop dia support for di rebel.

"Rwanda must stop dia support M23 and pull out dia soldier from eastern DRC," US Treasury Secretary Scott Bessent tok.

Di sanction dey come months afta Rwanda and DR Congo sign one US-brokered peace agreement, wit di aim to end di war.

Fighting don continue for eastern DR Congo since January 2025, wen M23 take ova Goma and Bukavu. Rwanda deny say dem dey back M23.

US Treasury tok say Rwanda defense ministry don direct thousands of soldier make dem fight side-by-side wit M23 for eastern DR Congo, dem give dem wit weapon, equipment, logistics and training.

M23 don seize mineral-rich areas for North and South Kivu, including gold mine sites for South Kivu and Rubaya, major-coltan producing area. Washington tok say minerals from rebel-occupied territory enta Rwanda supply chain, alleging say Rwanda export more minerals dan wetin dem dey produce.

Di sanctions suppose strengthen di Washington Accords, wey DR Congo and Rwanda presidents sign for December 2025 under US mediation. Di deal plan to end di conflict and expand regional trade and investment, but fighting don continue.

On 24 October, befor di sanctions announcement, DR Congo President Félix Tshisekedi urge di international community make dem increase pressure on Rwanda.

"We must firmly demand say di international community impose real sanctions against Rwanda and apply more pressure, so we fit finally get lasting peace for our kontri," e tok.

Inside one statement to Reuters, DR Congo foreign ministry welcome di sanctions and urge Rwanda make dem honour dia commitments under di Washington Accords, respect di UN Charter and pull out dia troops from Congolese territory.

"Di Washington Accords get clear commitments regarding Rwanda security, especially di neutralization of di DR Congo-sponsored FDLR genocidal militia, wey no dey happun at all, and nobody dey held accountable," Rwandan govment tok-tok pesin Yolande Makolo tell BBC.

Di FDLR na militia wey dey linked to di perperators of Rwanda 1994 genocide. Kigali consider am as security threat and dey cite dia presence for eastern DR Congo to justify im military posture.

"Rwanda remain ready to fully implement di Washington Accords, concurrently wit di willingness of DRC to fulfill dia commitments, and wit di mediator holding all parties accountable," she tok.

US also sanction Zigama Credit and Savings Society, one financial institution wey dey serve as Rwanda security services.

Washington allege say e help facilitate tens of millions of dollars transactions for M23 and dia political wing, Congo River Alliance, help pay for military equipment for Rwandan forces from China, and enable dem to transport gold from rebel-controlled areas go Kigali.

Wetin be sanction US sama Rwanda

Di sanction freeze di assets of di designated entities wey dey under US jurisdiction and generally stop US individuals and businesses from doing transactions wit dem, unless dem get authorization or exemption. Violation fit result in penalties for US and foreign parties.

Dis measures follow earlier US sanctions against Rwanda army and four senior military commanders for March 2026. US also impose more sanctions on Gasabo gold refinery and three mining companies wey dem accuse of smuggling conflict minerals for June 2026.

Pressure dey mount too ova Rwanda international sports partnerships. Two US senators don urge di National Basketball Association (NBA) to reconsider dia commercial relations wit Kigali, as dem dey question weda e aligns wit di league commitment to human rights.

Inside one letter wey dem send to NBA commissioner Adam Silver on 23 October, senators Jeff Merkley and Marsha Blackburn question di league continued partnership wit Rwanda amid allegations of human rights abuses.

NBA neva issue any substantive response to di letter.

Rwanda dey use high-profile sports sponsorship to raise im international profile. Early dis month, dem secure 10-year deal to host Formula 1 African Grand Prix for early 2030s.

Di country sponsorship of Arsenal end for 2026, while Bayern Munich don also end dia commercial partnership wit Visit Rwanda.