EFCC gbab former minister of power Saleh Mamman court sentence to 75 years in jail

Mugshot of Saleh Mamman

Wia dis foto come from, EFCC

Published
Read am in 4 mins

Di anti-corruption police for Nigeria, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don gbab former minister of power Saleh Mamman wey court convict recently for 33.8 billion naira ($24,625) money laundering offences.

On May 13, Court sentence Mamman to a total of 75 years imprisonment. Dem bin sentence am even though im bin no show face for court and di judge give order make security pipo arrest am anywia wey dem see am.

EFCC oga, Ola Olukoyede confam say dem arrest am around 15:00 GMT on Tuesday.

Dem arrest am wit two oda pipo wey bin dey protect am. EFCC say dem dey currently investigate di house wey dem arrest dem.

The EFCC boss described the development as "a testament to the commitment of the Federal Government of Nigeria to the fight against corruption in Nigeria".

"Dis na to assure Nigerians say anybody wey don take govment or national resources no go go unpunished, and di eagle eye of di Economic and Financial Crimes Commission go always catch up wit you anywia you dey hide," im tok.

Di court bin convict Saleh Mamman of all di 12 count charges wey EFCC sama am .

Mamman dey face over ₦33.8 billion for money laundering offences wey dey linked to di Zungeru and Mambilla hydroelectric power projects.

Di EFCC bin file charges against Saleh Mamman on January 2025. Di former minister bin allegedly convert ova ₦33 billion. Dis money na di money wey govment bin keep for corner to use do di Mambilla and Zungeru power project, na wetin oga Olukoyede give tori pipo.

"About 14 to 15 months down di line, specifically on di 7th of dis month, we secure convictions on all 12 counts. Becos di defendant bin no showface, di issue of and dem bin shift di issue of sentencing. And on di 13th of dis month, dem sentence even though im bin no show face.

Oga Olukoyede say na since dat time dem decide to "open our intelligence surveillance to di public, as we dey find am ova di place. "

Nigerians bin dey worry how Mamman go take serve im jail term but Justice Omotosho bin tok say even though im bin no showface for court, im jail term go begin count anyday wey dem arrest am.

Di judge order all security agencies, plus international police (Interpol) to arrest Mamman anywia wey dem see am.

Di judge also say if dem see am make dem hand am ova to di Nigerian Correctional Service sharp-sharp to start in jail term.

Court rule say na anytime dem arrest am, im jail term go begin count.

For di judgement, Justice Omotosho rely on di provisions of di Administration of Criminal Justice Act, 2015 in agreement wit di EFCC counsel, Rotimi Oyedepo (SAN), dem sentence am even though im no showface for court.

Court give judgement few days afta Oga Mamman pick form to contest for govnorship for Taraba State ahead of di 2027 general elections under di All Progressives Congress (APC).

As e be so, Mamman wey bin serve as di minister of power under di late former Nigeria President, Muhammadu Buhari dey try to becom di govnor of Taraba State despite dis big corruption mata.

Wit dis judgement and wit di order wey court give security agencies to arrest am anywia wey dem see am, e mean say im political career and ambition for di 2027 election fit dey on hold.

EFCC don finally put dis tok to rest as dem go hand am ova to security pipo or to di Nigeria Correctional Service.