APC Primaries: Cubana Chief Priest, Fubara loyalists, odas lose 2027 House of Representatives bid

Published
Read am in 5 mins

Nigerian socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest don react to tori say im lose di All Progressives Congress (APC) primary election for di Orsu/Orlu/Oru East Federal Constituency seat for Imo State.

For series of post on im Instagram story on Sunday, Okechukwu clear am say, im no even take part for di primary election, as e say im voluntarily withdraw from di race afta di state govnor, Hope Uzodimma explain to am di position of di party on zoning within di federal constituency.

Dis im latest reaction appear to dey different from one video wey e take express disappointment ova di outcome of di primary.

For di video, e say im only regret na "trusting di elders for di community" afta tori say e secure only 14 votes.

Nigeria President son, Seyi Tinubu afta di result of di primary, bin tag am for one post wey e take cheer am up. "Bro, sometimes, by losing a battle, you find a new way to win di war. Keep your head up. We know wetin you fit achieve." Seyi bin tell am for di post wey e acknowledge.

On how di primary take waka, Okechukwu say di govnor maintain say make Orlu Local Government Area complete at least two terms in office bifor di seat rotate go anoda council area, and im respect di party position.

"E make di argument say no be di turn of my Local Government Area to occupy di seat at dis time, especially as na my elder brother, Asiwaju Jerry Alagboso, don previously serve three terms for di House," Okechukwu post.

Di socialite also add say as di party don adopt di zoning arrangement, im abandon di race and no participate for di primary.

"Nobody go tok say dem see me anywia near di primaries venue. Infact, I no participate, I just carry myself straight back to Lagos. Pipo from my constituency fit attest to di fact say nobody see me for any primaries election venue."

E add say as na for di early morning, bifor di primaries dem tell am di decision of di party, and im stay away completely.

Cubana Chief Priest lost for primary

Nigerian socialite Pascal Okechukwu don lose di primary election for di House of Representatives seat for Orsu/Orlu/Oru East Federal Constituency of Imo State ahead of di 2027 general elections.

Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest bin run under di platform All Progressives Congress, but e fail to secure di party ticket to contest for di election.

Di primary election for di House of Representatives bin hold on Saturday, 16 May and na part of preparation for di 2027 general elections.

Na di primary election dey decide di candidate wey go represent di party for di general election.

Aspirants wey indicate interest to run for any elective seat go first buy nomination or interest form, then di party go screen di aspirants, afta di screening, successful ones go go ahead wit di primaries, wia delegates go vote for di pesin wey go represent di party for di election.

Na any candidate wey win for di primary go contest for di election.

Di socialite neva react to di tori of im loss.

Earlier bifor di primaries, Cubana Chief Priest wey also be di coordinator of City Boy movement Imo state post for im Instagram account say im still dey consult and dey hope for di best.

"Still Consulting, CP neva sleep, Hia na di last lap of my consultation. Hoping for di best as we fight to finish."

E be strong supporter of di current administration.

APC disqualify Reps aspirants across states

Meanwhile, earlier on Saturday, di All Progressives Congress bin release di names of aspirants wey no dey cleared to participate for di House of Representatives primary election.

Di party for statement wey di National Publicity Secretary Felix Morka issue tok say di aspirants pass di screening but dem no qualify for di primaries.

Di party no tok di reason for dia "not cleared" status.

According to di party, di screening panels assess candidates based on di APC approved guidelines and procedures to determine dos wey dey qualified to participate for di forthcoming primaries across di various federal constituencies.

"Di Party Screening Committees conduct di screening exercise in line wit established procedures and guidelines," di statement tok.

Three aspirants from Rivers state wey govnor Sinimalayi Fubara back no dey cleared for di primaries.

Full list of aspirants wey di party disqualify:

Ondo State (Not cleared aspirants)

  • Hon. Adefisoye Tajudeen
  • Olusegun Victor Ategbole
  • Seun Oluwashina Ajongbolo
  • Rt. Hon. Arowole Ayodeji Samuel
  • Morufu Tosin Ibrahim
  • Oseni Oyeniyi
  • Olaleye John Adedipe

Bauchi State

  • Dr. Bashir Ibrahim Bello

Ebonyi State

  • Hon Idu Igariwe

Kogi State

  • Sanni Salau Ogembe

Rivers State

  • Air Commodore John Azubuike Opara, Uni (RTD)
  • Hon Anderson Allison Igbiki
  • Awaji Imombek D. Abirite
  • Hon. Boma Goodhead