2026 Fifa World Cup quarterfinal matches and previews

morocco is looking to win the cup this time

Wia dis foto come from, PABLO MORANO/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, France v Morocco be repeat of di 2022 semifinal; Le Bleus bin win dat game 2-0
Published
Read am in 8 mins

Gradually di World Cup don dey reach wia we fit find wey teams go jam for di final for di New York New Jersey stadium for 19 July.

So far ogbonge teams comot, some underdogs like Cape Verde also bin shine for dia first eva appearance.

Morocco be di last African team wey still dey for di tournament afta Argentina comot Egypt for di R16.

Teams like Norway and Paraguay also comot Brazil and Germany for di competition.

Di quarterfinals get one African team, six European teams and one team from South America.

Dis eight teams go battle for dia place for di semifinal but which of dem go make am?

Dis na di preview for all four quarterfinal games for di World Cup.

Morocco v France preview

France are favourites, Morocco says they are in to win

Wia dis foto come from, CATHERINE IVILL/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di leading scorer for Morocco Ismael Saibari (3 goals) go miss di game wit injury

France be di favourite for dis game according to many pundits.

Les Bleus get firepower for dia team wit dia captain Kylian Mbappe wey get seven out of dia 14 goals for di tournament.

Dem also get Michael Olise wey get di highest assists for di competition (5), togeda wit Ballon D'or winner Ousmane Dembele wey get four goals.

In fact, France qualify from di group stage wit maximum nine points – dem beat Senegal 3-1, Iraq 3-0 and Norway 4-1.

France later sama Sweden 3-0 bifor dem scrape through to win 1-0 against Paraguay wey give dem plenty wahala.

For Morocco, dem also bin jam wit ogbonge teams.

Di Atlas Lions hold Brazil to 1-1 draw, bifor dem beat Scotland 1-0 and Haiti 4-2.

Morocco later sama Netherlands for penalties bifor dem beat co-hosts Canada 3-0 for di R16.

Dia path to dis quarterfinal bin dey different but di objective for di two teams remain di same.

Morocco go dey hope to avenge dia 2022 defeat to France (2-0) for di semifinals for Qatar.

Di Atlas Lions set record at dat time as di only African kontri to reach di semifinals of di World Cup.

France later lose di final for Qatar for penalties to Argentina – Lionel Messi and im boys win di World Cup dat year.

But France go hope say dem fit win am dis year – if dem reach di final, e go become di second team for Europe (afta Germany) wey go reach three consecutive World cup finals.

Di team wey go win dis game go reach di semifinals and jam wit either Spain or Belgium for Dallas on 14 July.

France coach Didier Deschamps tok say "we gatz dey efficient for attack, Morocco gat top players, dem no dey hia to play, dem dey hia to win. We gatz dey ready and deliver against dis ogbonge team."

Morocco coach Mohamed Ouahbi say "we no go listen to pipo wey dey hype us, we dey hia to get more, to win. France be favourites but we go do everitin possible to win and qualify for di semis."

France possible XI

Maignan; Kounde, Upamecano, Saliba, Digne; Kone, Rabiot; Olise, Dembele, Barcola; Mbappe

Morocco possible XI

Bounou; Hakimi, Diop, Halhal, Mazraoui; Bouaddi, El Aynaoui; Diaz, Ounahi, El Khannouss; Rahimi

Di game go happun at 8 PM GMT (9 PM WAT) for di Boston Stadium.

Spain v Belgium preview

spain are favourites but Belgium has grown into the tournament

Wia dis foto come from, ALEX GRIMM/MOLLY DARLINGTON/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Belgium miss di 2010 tournament but dem reach di quarterfinal for 2014, bifor dem finish third for 2018. But dem comot for group stage for 2022

Spain don reach di quarterfinal of di World Cup for di first time since 2010 when dem win di trophy for South Africa.

Belgium miss di 2010 tournament but dem reach di quarterfinal for 2014, bifor dem finish third for 2018. But dem comot for group stage for 2022.

Di two teams go jam each oda for Los Angeles – dem both finish di group stage without defeat.

Spain sama Austria 3-0 for di R32 bifor dem comot Portugal afta dia late 1-0 win; Belgium sama Senegal 3-2 for extra time for R32 wey dem scata co-host USA 4-1.

Belgium go dey count for dia key players Yuri Tielemans, Kevin De Bruyne and Thibaut Courtois to defeat di European champions.

For Spain, dia starboy Lamin Yamal dey fit, wey im go hope to inspire La Roja togeda wit Rodri, Pedri, Alex Baena and di odas.

Spain no concede goal yet for dis world cup so far afta five game.

Unai Simon dia keeper don set record as im keep clean sheet afta 609 minutes of football wey im go hope im defensive team – Cubarsi, Laporte, Cucurella, Pedro Porro dems go shine again when dem jam wit di Red Devils.

Belgium keeper Thibaut Courtois say "Spain na favourite, dem be excellent for possession wey dem dey press quickly whenever dem lose di ball. We gatz take advantage of di space behind dia defence.

Spain captain Rodri say im team gatz improve afta dia performance against Portugal.

"We and Belgium get similarities, we want di ball, but we gatz dey sharp to do damage to di opponent; for football dis days, you gatz speed up di tempo for di final third."

Spain possible XI

Unai Simon; Porro, Cubarsi, Laporte, Cucurella; Rodri, Pedri; Lamine Yamal, Dani Olmo, Baena; Oyarzabal

Belgium possible XI

Courtois; Castagne, Mechele, Ngoy, De Cuyper; Tielemans, Raskin, Vanaken; Lukebakio, De Ketelaere, Trossard

Di game go happun at 7 PM GMT (8 PM WAT) for di Los Angeles Stadium.

Norway v England preview

ENGLAND are favoutites

Wia dis foto come from, ULRICK PEDERSON/STEPH CHAMBERS/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, England and Norway bin face each oda 12 times; England bin win seven wey Norway win only two, di rest end for draw

Norway make history by reaching di quarterfinal for di first time afta dem beat Brazil 2-0 to comot di Seleccao.

Erling Haaland na di star for di Vikings as im score seven of dia 11 goals for dis tournament.

Norway don 'row dia boat' to dis stage afta dem finish second for di group stage behind France.

Dem later sama Ivory Coast 2-1 for di R32 bifor dem comot Brazil.

Dia opponent England also din finish as group winners bifor dem beat DR Congo 2-1 for di R32.

Di Three Lions sama host kontri Mexico 3-2 for di Azteca stadium for one of di best games for dis tournament.

England wit 10-men win dat game wey get everitin, good goals, penalties, high intensity among odas.

Harry Kane dia captain get six goals, im go hope to lead di Three Lions from di front togeda wit Jude Bellingham wey get four goals.

England and Norway bin face each oda 12 times; England bin win seven wey Norway win only two, di rest end for draw.

Dis game go see many players wey dey play for di English premier league meet each oda.

Haaland go face im club teammates Marc Guehi and Nico O'reily; Martin Odegaard go also meet im club teammates Declan Rice, Bukayo Saka, Eberechi Eze.

Norway captain Martin Odegaard say "we sabi di quality dem get, we sabi dem well. Dem get ogbonge players wey dey play for one of di best national teams for di world. Dis game go be tough test for us".

"We gatz believe for ourserf, we don show di world say we be good team. For football, anytin dey possible, even though we be di underdogs again, but we go see wetin go happun."

England midfielder Morgan Rogers say dem dey determined to make more memories for di tournament.

Di winner for dis game go reach di semifinal and jam wit Argentina or Switzerland on 15 July for Atlanta.

Norway possible XI

Nyland; Ryerson, Ajer, Heggem, Moller Wolfe; Berg, Berge, Odegaard; Sorloth, Haaland, Nusa

England possible XI

Pickford; Konsa, Stones, Guehi, O'Reilly; Rice, Anderson; Saka, Bellingham, Gordon; Kane

Di game go happun at 9PM GMT (10 PM WAT) for di Miami Stadium.

Argentina v Switzerland preview

Argentina are favourites

Wia dis foto come from, MICHAEL REAVES/JARED C. TILTON/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Argentina and Switzerland bin face each oda seven times – Argentina win five wey dem draw two

Di defending champions go jam wit Switzerland afta dia historic R16 comeback against Egypt when dem win 3-2 afta dem bin dey lose 2-0 afta 78 minutes.

Lionel Messi once again inspire im team wit one goal and one assist; di Argentine star now get eight goals and two assists for di tournament.

Egypt bin argue say di officials for di game no treat dem fair as dem expect say dem go get last-minute penalty when Mohammed Salah fall for ground inside di box.

Replays bin show say Julian Alvarez bin win di ball, bifor Salah collide wit im standing leg wey im fall for ground.

Egypt manager Houssam Hassan accuse Fifa say dem dey prepare di World Cup for Argentina to win am, allegations Fifa don deny through dia Fifa Referees' Chief Pierluigi Collina.

Collina say di allegations against di match officials dey "unfounded".

"Nobody fit question di integrity of Fifa World Cup match officials, constructive discussions always go dey part of football, but unfounded allegations get no place for our sport."

Argentina bifor di Egypt game, Argentina beat Cape Verde 3-2 afta di African Kontri match di world champions boot-for-boot.

Switzerland defeat Colombia for penalties for di R16 to reach di quarterfinal.

Di Swiss also sama Algeria 2-0 for di R32.

Dis be Switzerland dema first quarterfinal since 1954.

As underdogs for dis quarterfinal game, di Swiss dey hope to use dia performance against Colombia as motivation.

Argentina and Switzerland bin face each oda seven times – Argentina win five wey dem draw two.

Switzerland coach Murat Yakin say dem fit beat Argentina to qualify for di semifinals.

"We dey play against di world champions, but di last two matches against Cape Verde and Egypt don show say Argentina dey vulnerable."

"Di game go dey tactical, we fit challenge di champions."

Argentina possible XI:

E. Martinez; Molina, Romero, Li. Martinez, Medina; Paredes; De Paul, Fernandez, Mac Allister; Messi, Alvarez

Switzerland XI:

Kobel; Zakaria, Elvedi, Akanji, Rodriguez; Jashari, Xhaka, Freuler; Ndoye, Embolo, Rieder

Di game go happun at 1 AM GMT (2 AM WAT) for di Kansas City Stadium.