Trump threaten to hit Iran 'hard again tonight' afta e say ceasefire don end

Wia dis foto come from, Win McNamee/Getty Images
Donald Trump don threaten to attack Iran "hard" tonight, hours afta e tok say di US-Iran ceasefire don end.
Trump wey dey Nato summit for Turkey earlier tok about di Iranian leadership.
"I no wan deal wit dem anymore, dem be scum. Dem be sick pipo, na sick pipo dey lead dem," dis na wetin Trump tok about Iran leaders.
Trump add say negotiators on both sides fit continue to dey tok, but e say dem fit just dey "waste dia time".
Dis comments dey follow afta both kontris exchange attacks. Late on Tuesday, di US say e fire more dan 80 Iranian targets.
In response, Iran say e dey target US military sites for Bahrain and Kuwait.
Di US strikes on Tuesday follow attacks on three oil tankers for di Strait of Hormuz. Iran neva directly claim responsibility
Last month, Tehran and Washington sign 14-page memorandum of understanding, wey extend di ceasefire and aim to end di conflict.
US Central Command (Centcom) tok on Tuesday say dem don sama more dan 80 targets wey include ova 60 Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) small boats.
Iranian state media tok say di strikes bin hit areas like Bandar Abbas and Sirik wia sharpnel injure some pipo for dia.
Dis dey come afta attacks on three oil tankers for di Strait of Hormuz wey Iran no claim responsibility for.
Di Nato oga Mark Rutte bin call di US strikes "absolutely necessary" as im accuse Iran say dem dey "basically violate di ceasefire" wit "ships wey dey attacked".
Iran parliamentary speaker Mohammad Bagher Ghalibaf tok say na US wey breach di so-called memorandum of understanding (MoU) by say dem, "violate Iranian adjustments for di Strait".
Na last month Tehnran and Washington bin sign one 14-page MoU, wey bin dey to increase di ceasefire and end di kasala "on all fronts".
Meanwhile, for di kontris wey dem dey strike, dem don dey match leg for ground.
On Wednesday morning, tori comot of alarms wey dey sound for Bahrain.
Dis na as di IRGC say "di naval and aerospace forces of di Islamic Revolutionary Guard Corps for collabo missile and drone operation sama 85 key American military installations for Salman Port wey be di US Fifth Fleet area for Bahrain".
Di Iranian military also tok say dem don target di Ali Al Salen Air Base for Kuwait.
In response di Kuwait foreign ministry don condemn wetin dem call di "repeated heinous Iranian aggressions".
For statement, dem tok say dis "brazen aggressions" dey go against efforts to reduce tensions and strikes "for time wey regional and international efforts aimed for de-escalation dey go on".
Di foreign ministry tok say Kuwait get right to do evritin necessary to protect dia security.
How dis mata don affect oil price
Oil prices don jump up by more dan three percent following di strikes. Di international benchmark wey be barrel of Brent Crude don climb to $76.
Dis na di prices wey bin drop to pre war times afta di US-Iran truce agreement last month.
But dis fresh attacks don start to dey fear pipo about di flow of traffic through di Strait of Hormuz wey normally a fifth of all di world oil dey pass through am.
No be only new strikes US dey sama Iran, dem don aso comot di temporary authorisation of Iran oil sales.
Dis authorisation bin dey for di MoU wey dem sign last month wey allow for di sale of Iran crude oil, petrochemical nad petroleum products till 21 August. Na documents from di US Treasury on Tuesday confam say dem don sama di restrictions back.









