Five reasons why Osun State govnor Adeleke dey re-elected for second term

Wia dis foto come from, @Ademola Adeleke/X
Osun state citizens don return govnor Ademola Adeleke wit dia votes on Saturday to serve for di second term for di just concluded Osun state govnorship election.
Di Returning Officer Joshua Olalekan Ogunwole announce im victory for di keenly contested poll on Sunday morning.
Adeleke wey run on di platform of di Accord Party beat 14 oda contenders to emerge as winner or di polls.
Wit 511,067 votes, Adeleke defeat im closest challenger, Bola Oyebamiji of di All Progressives Congress wey poll 444,815 votes.
Im victory dey come afta e hit one major fall few months earlier for im political career, wen di Peoples Democratic Party (PDP) wey e run as govnor for di first term scata sake of lack of coordination of leadership for di central level and factions wey break out within di PDP.
Adeleke enta di gubernatorial race through di Accord Party - one small party wey no dey too popular, and at the time, many pipo bin see am as risk and wonder how di small party go take face political parties wey don already get name and wey get populat politicians.
Also, many bin no believe say e go fit repeat di 2022 electoral victory, wey e take beat di ruling party and unseat di then govnor Adegboyega Oyetola, but e prove im political stronghold for dis election.
So, dis na some of di factors wey make Adeleke win and carry majority of di votes for Osun State.
End of Di one wey oda users dey read well well
EFCC freeze Osun State govment account
Barely days to di election, Economic and Financial Crimes Commission bin freeze di account of di govment of Osun State ova corruption allegations.
EFCC tok say dem dey investigate Osun State account sake of say dem suspect some magomago wey dey go on, but dem go need to freeze di account wen dem observe how moni bin move from dia to "different suspicious accounts since 2 August".
However, President Bola step into di mata and order EFCC to comot hand from di account.
Salary payment
During Adeleke first term for office, e bin show workings well-well for di state. As e care for di welfare of di state workers.
Adeleke keep good relationship wit civil servants as im dey pay salary on time, help workers wit career growth, and dey settle pensioners.
Afta Osun State residents bin elect am, e pay all di backlog salaries wey di previous administrations dey owe dia workers wey be di major supporters of Adeleke.
Inside one interview, Adeleke, tok say im administration don pay ova N80 billion ($58.8m) of di pension debt wey e inherit and ova two-thirds of di half-salary wey di state dey owe workers.
Adeleke tok say welfare of workers dey give am joy. "I dey proud of wetin I don achieve for di last four years. I happy well-well say we don do plenty tins for pensioners and workers for Osun State. Di pensioners, dem dey happy wit me. Di workers know say I dey do my best."
Civil servants wey be di largest workforce for Osun state na dem be di strongest supporters of Adeleke becos of some of di benefit wey dis workers don get and dis election victory na dia victory.
Keep to im campaign promises
One major strength for Adeleke na di visible work of infrastructural development by im adminstration in Osu state.
Many don argue say govment no really build infrastructure wey go boost and support Osun economy, while odas dey encourage im adminstration to build more infrastucture for rural areas.
During im first adminstration, Adeleke expand food security by supporting farmers, support educational sector and provide good healthcare services. According to Adeleke, im adminstration build 350 kilometres of roads, three flyover bridges, six good roads, rehabilitate ova 200 primary healthcare centres, rehabilitate 150 schools and provide 31 new tractors to farmers.
Dis na some of di reasons Osun residents support Adeleke.
Undefeated energy
Adeleke dey popular among im people as dem fit relate wit im govment especially young pipo and workers for di state, unlike di previous govment.
Di govnor dey like to jolly wit im pipo as e dey often seen to dey dance for public places, even though im rivals get contrary view about di dance and don call am "unserious".
Days bifor di elections, Adeleke bin grant interview wia e tok say im know say im go win di election.
"My pipo, I wan use dis chance thank you well-well for your support, and I know say your conscience dey tell you say I no fall una hand. Una don waka round, you don see di work wey our govment dey do.
"Just to mention, we don resolve all di infrastructure, solve all di needs wey our people get, and I wan make you judge am from dat area and look wetin we don achieve so far, na dat one you go take use base your judgement."
"Now about di election, if I go lose di election? Number one, forget about dat one. I no go lose dis election becos I dey very confident. I no go lose dis election."
Outburst of kasala for Osun
Months bifor elections for Osun, many kasala bin happun across di state. As report of violence dey break for local media, ova 73 election related violence happun across di capital.
Police reports about 12 deaths related to violence for 14 LGAs during di period.
Adeleke also alert di president and police IGP make dem intervene and provide adequate security.
Di govnor also claim say im party faithfuls dey face intimidations from im political rivals and police
"On a daily basis, police dey arrest my members. Dem don arrest four Accord leaders.
For di run to di election wey dey tense, di senator wey ey represent Osun East for di National Assembly, Francis Fadahunsi, bin make one comment wey make pipo para and wey dem see as intimidation ahead of di election.
However, di senator bin deny di video, as e say di video na AI generated and wetin e tok na to "kill dem by dia votes".













