Family of Nigerian gospel singer Toluwanisings confam im death

Wia dis foto come from, @toluwanisings/Instagram
Di family of Nigerian gospel singer Olayemi Bayonile Bolaji wey pipo sabi as Toluwanisings don confam im death on Wednesday 14, October.
Dem confam di death of di gospel singer inside one statement ontop im official Instagram page afta reports bin emerge on social media say Toluwanisings don die.
"Wit deep sorrow, di family announce di passing of Minister Olayemi Bayonile Bolaji wey die for di early hours of 14 October 2026.
"A dearly loved husband, family member, and gospel minister. Please keep im wife, family, and loved ones for your prayers during dis difficult time.
"Funeral arrangement go dey announced by di family in due course," di statement tok.
Di family no mention di cause of Toluwanisings death but tori be say im bin slump for im house for Ibadan, di Oyo State capital, and dem rush am go hospital wia e kpai.
Reports of Toluwanisings death begin trend afta Nigerian lawyer Pelumi Olajengbesi post dis on im Instagram page wit di handle @pelumi.olajengbesi: "My God! What a life! No, Lord! We plead for Your mercy upon Toluwanisings.
"I dey deeply troubled by di deaths of young men and women. Dis no be God's plan for us. We say no to untimely death!"
Afta Olajengbesi post, Nigerian comedian and gospel entertainer Ayo Ajewole aka Woli Agba say make pipo neva conclude and say dem still dey trust God.
"Please hold on. Please no conclude. We dey trust God," Woli Agba write for im Instagram page wit di handle @woliagba_ayoajewole.
Many pipo begin pray say make di news of Toluwanisings death be fake tori bifor im family kon confam am via im official Instagram page.
Afta di official announcement, tributes begin pour in for di gospel minister wey many pipo say bin dey hardworking.
Dis dey come two years afta di death of anoda gospel singer Aduke Ajayi aka Aduke Gold wey die for University College Hospital (UCH) Ibadan for August 2024.
Dem bury Aduke Gold for Ikorodu area of Lagos on Friday, 23 August 2024.
Who be Toluwanisings?
Toluwanisings na Nigerian gospel singer, songwriter and music minister wey im real name na Olayemi Bayonile Bolaji.
E dey popular for im energetic praise songs, Yoruba-inspired gospel music and contemporary worship recordings.
Im music dey combine indigenous Nigerian gospel music wit contemporary sounds and make am popular among gospel music audiences on streaming platforms and social media.
For July 2026, Toluwanisings and members of im music crew bin survive accident wey involve dia bus and one fully loaded trailer as dem dey return from one gospel ministration.
E give informate about di incident for one Instagram post and upload di foto wey show dia damaged bus.
"And we survive wetin fit don claim our lives. My Israel no go die for di hands of Pharaoh LAYELAYE. Wen di enemy come like a flood, di spirit of di lord raise a standard against dem!
"Dis na how my team and I fit don dey totally crushed by a fully loaded trailer on our way from one ministration dis morning," e write for Instagram.




















