Pupils and teachers wey gunmen kidnap for Oyo State regain freedom

Teachers kidnapped in Oyo

Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X

Published
Read am in 2 mins

Di teachers and school children jaguda pipo kidnap from three schools for Orire local govment area of Oyo state, southwest Nigeria don regain dia freedom, Presidency tok.

Tok-tok pesin to President Bola Tinubu, Bayo Onanuga for one post on im official X account on Friday, 10 July, announce say Nigerian security agencies don rescue di abducted teachers and pupils wey suspected bandits kidnap from dia schools on 15 May.

Onanuga add say during di rescue operation, security agents arrest eight of di kidnappers and dem currently dey di custody of di Department of States Service (DSS), Nigeria secret police, while dem kpai some of dem.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Oga Onanuga add say, dem no give in to any special deal or exchange for di rescue operation wit di kidnapper.

"No exchange or special deal dey for dis rescue operation. Di kidnappers bin dey demand for di release of one terrorists, wey be Oga, but e currently dey face prosecution for all im sins," e tok.

Di presidency bin share videos and fotos of di released pupils and dia teachers.

For inside one video, wey Onanuga share along di statement, one woman believed to be one of di rescued teachers bin dey thank President Bola Tinubu and security forces for dia release. Di schoolchildren for inside di video join di teacher to shout, "Thank you, sir," wen she tok finish.

"Hello sir, our father, we dey grateful, di President sir, we dey grateful, we understand your commitment to our safety and we appreciate evritin wey you do for us. Thank you! All di security operatives try so much and dat na why we still dey alive. Thank you sir," she tok.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Local tori say di bandits kill one school teacher during di attack, and later also kpai anoda teacher inside di forest.

Di attack happun for Baptist Nursery and Primary School (Yawota), Community Grammar School (Esiele), and L.A. Primary School for Ahoro-Esinele, Oyo State.

Di govment blame di abductions on one faction of di Islamist militant group, Boko haram.

Di attack bin generate plenty reactions as plenty pipo para, members of di Nigerian Union of Teachers (NUT) plus oda stakeholders, wey dey demand urgent action bin protest and schools for Oyo state bin go on strike.

NUT bin describe di attacks as "barbaric and inhuman," and warn say continued attacks on schools fit force teachers nationwide to withdraw dia services.

More dan 1000 kilometres away for Mussa town, Askira Uba local govment of north-eastern Borno state, parents still dey mourn di absence of dia children.

Di situation wit di Borno school children neva dey clear, as di focus bin mostly dey on di Oyo school kidnap.

Plenty reactions don follow fi release of di abducted Oyo state victims, Oyo state govnor Seyi Makinde express joy at di safe return of di children and teachers jaguda pipo gbab from Oriire LGA 56 days ago.

"Our priority now na reunite dem wit dia families and support dia rehabilitation afta dis traumatic experience," e tok.

Di Oyo state leader also hail di security agencies wey take part for di rescue operations for dia sacrifices.