US go revoke passports of parents wey dey owe child support - who go dey affected?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Sareen Habeshian
- Read am in 3 mins
Di US State Department tok say dem go begin revoke di passports of Americans wey owe big amount of money for child support.
Di department announce say parents wey owe money wey pass $2,500 (£1,844) in child support payments fit dey affected, but dem go target dose wit "significant outstanding" debt.
Di State Department say dem go use "common sense tools to support American families and strengthen compliance" wit US laws for manner wey dem tok say go compulsory parents "legal and moral obligations to dia children".
Di department advise dose wey owe dat kain debt to arrange payment to relevant state agencies to prevent passport revocation.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Once dem revoke pesin passport, di pesin no go fit use am travel again. Dose wey dem cancel dia passports no go dey eligible for new one until dem don pay dia child support gbese, di State Department tok.
"Dis action dey support di welfare of American children by exacting real consequences for pipo wey dey fail for child support under existing federal law," di department tok for statement.
Passport revocations for unpaid child support of more dan $2,500 dey allowed under one 1996 federal law wey dem rarely dey enforce.
Bifor, na wen pipo wey owe plenty debt and wan renew dia passports dem dey face di consequences.
Wit di new policy, di State Department say dem go work wit di US Department of Health and Human Services to identify dose wit outstanding debt and revoke dia passports.
Di department no tok wen dem go begin enforce di policy but di Associated Press reported say e go start on Friday, 8 May. BBC don contact di State Department.
Pipo wey dey outside di US at di time of revocation go need visit US embassy or consulate to get emergency travel document wey go allow dem re-enta di kontri, AP report.










