Dem fit join back man gbola afta dem don cut am?

Wia dis foto come from, Getty Images
Since di news break earlier dis week about one young woman wey dem accuse say she cut off her boyfriend penis, plenty pipo don dey ask weda e possible to join back di penis make e work normally again.
On Monday, Kano State Police Command tok say dem arrest one 25-year-old woman wey dem allege say she cut off her boyfriend penis while e dey sleep inside one hotel room wey dem lodge for Kano.
Di young woman wey dem accuse of doing di act reportedly use one sharp knife wey she carry come from Maigatari town take cut off di man penis completely.
Dis one make BBC tok to sabi pesin about weda dem fit join back penis, as dem tok wit Dr Jibrilla Usman Atiku, one consultant urologist for Aminu Kano Teaching Hospital.
Wetin dem gatz do afta dem cut off penis?
"For some cases, e possible to join back person penis or reconnect penis wey don cut, but e depend on di type of injury and how quick di person get medical treatment," Dr Jibrilla tok.
However, di doctor explain say di first emergency step after penis don cut na to preserve di penis wey don cut so dat e no go spoil.
"Dem fit do di operation if dem bring di penis within wetin dem dey call 'Golden Hours' or di first few hours afta di injury.
Dem fit also wash di penis, wrap am inside nylon bag and put am for ice. Dis one fit stop am from spoiling for between 12 and 24 hours, just like how dem dey preserve kidney before dem transplant am into another person for another place."
"If di penis never stay too long after e cut, doctors fit do surgery by reconnecting di blood vessels, similar to how dem dey do kidney transplant. Dem dey call am microvascular surgery. But na major operation, and dem never dey do am for Nigeria. Even for Europe and America, no be evri medical centre dey perform am," Dr Jibrilla tok.
Di specialist add say if dat method no possible, anoda option still dey.
"...Anoda artificial penis dey, wey resemble prosthesis, wey dem fit implant make e replace di function, just like how dem dey fit artificial leg for person wey lose leg. In di same way, if part of di penis still remain, dem fit open am and fit one special prosthetic device inside," Dr Jibrilla tok.
Wetin dem fit do if na only part of di penis bin cut?
Dr Jibrilla tok say difference dey between cutting off di whole penis and cutting only di head of di penis.
"Di head of di penis na di part wey dey feel touch pass. If dem cut am, and di patient reach hospital quickly, doctors fit reconstruct am so di person fit regain some feeling and sexual satisfaction. Di satisfaction no go be exactly like bifor, but di person still fit have sex," Dr Atiku Jibrilla tok.
Di penis fit work again afta dem join am back?
Di doctor tok say just as wound dey heal gradually, na so di penis too go gradually regain im function.
"E go begin work gradually before e recover, although e no go return reach one hundred percent. But di person still fit have sex and get satisfaction. After all, di penis get two main functions: to urinate and to have sex for satisfaction."
Wetin go if dem cut di testicles?
"Na for di testicles sperm cells dey form, wey give man ability to born children. Na dem too dey produce di male hormone wey dem dey call testosterone, wey dey responsible for sexual desire and other reproductive functions, as well as beard growth and deep voice."
"Dem dey produce about 90 percent of di testosterone, while di remaining 10 percent come from di kidney. So, if dem remove man testicles, di main problem be say e no go fit born children. E fit still get sexual desire, have sex and get satisfaction, but im sexual desire go reduce, and e fit also suffer depression."
"Dis testosterone hormone na wetin dey give man strength, energy and even happiness. If e no dey, di person fit become depressed, lose interest for everything, and e fit even lead to death."
Person fit live witout penis?
"Yes, person fit live witout penis. E no go die simply sake of say e no get penis. But e no go get peace of mind bicos of di importance of sex life to man. Na wetin dem dey call dying while still alive," Dr Jibrilla Atiku tok.






