How police rescue British woman afta shootout wey lead to death of four suspected kidnappers

Wia dis foto come from, Handout
- Author, Wycliffe Muia
- Published
- Read am in 3 mins
Police don rescue one British woman wey dem kidnap for Malawi nearly one week ago for one operation wey kpai four suspected kidnappers and injure one senior police chief.
Dem free 47 years old Nusrat Osman, on Thursday during di operation for di outskirts of di southern city of Blantyre, police tok.
Officers bin exchange fire wit di suspected kidnappers; police say dem bin dey use AK-47 rifle and pistol.
"Di criminals chop gunshot wey dem rush dem to hospital wia dem die from dia injuries," di Malawi Police Service tok inside one statement.
Deputy Inspector General of Police Noel Kayira, wey bin dey involved for di operation, also suffer gunshot injuries, im dey get treatment for hospital. Di police say im dey stable condition.
Osman now reunite wit her family afta di rescue wey dem carry her go hospital for treatment, according to local media.
Her younger brother, Shobi Jiwa, don praise di Malawi police for her release, wey dem tok di UK Sun newspaper say di family dey grateful for di effort of di security agencies wey bin dey chook eye for di kidnapping.
Im also appreciate Kayira, di police chief wey dem shoot for dis rescue operation, dem describe am as di "hero" of di family as im put im own life for risk to save her.
Police neva identify di four suspected kidnappers wey kpai wey dem no yet give oda details about how di officers bin find dis kidnappers.
Four unidentified men bin abduct Osman for one neighbourhood for Blantyre on 11September.
Police say she bin dey drive to her house when di men block her car, wey dem force her into anoda car bifor dem drive away.
Afta she don miss, authorities begin search operation wey dem offer 30 million Malawian kwacha ($17,000; £12,500) for informate wey go lead to her rescue and di arrest and conviction of di pipo wey dey responsible.
Osman, comot Leicester for di UK, wey she don stay for Malawi for many years, she bin dey work for one auditing company. She dey married wit two young pikin.
Di UK Foreign Office first tok di BBC say dem dey aware of reports say dem abduct one British national for Malawi wia dem dey in touch wit local authorities.
Police tok say di kidnappers neva demand ransom wia dem neva communicate wit fi family afta she don disappear.
Her family bin appeal to di public for her safe return.
Police neva tok wetin fit be di possible motive for dis case dem no also tok if oda pipo dey involved.
Dem dey continue dia investigation for dis mata wey dem ask di public to dey calm.






