Miley Cyrus marry her partner Maxx Morando for one ceremony for California

Miley Cyrus and Maxx Morando smile as dem siddon near each oda for one awards ceremony. Cyrus dey wear white collared shirt and black leather jacket. Morando dey wear one black t shirt
    • Author, Henry Moore
  • Published
  • Read am in 4 mins

Three-time Grammy winner Miley Cyrus don marry her partner of four years Maxx Morando during one ceremony for Palm Springs, California.

One black and white photos shared wey di Flowers singer on Instagram show as di couple dey kiss as white roses surround dem.

Pipo fit see her mother, Trisha Cyrus, and sister, Noah Cyrus, for di background of one of di foto.

Her father Billy Ray Cyrus no show for di picture but e dey for di ceremony wit im partner, actress Liz Hurley.

33-year-old Grammy-winning Cyrus wear one white silk dress wey Anthony Vaccarello design for Saint Laurent, while 28-year-old drummer Morando say "I do" for one black suit from di same fashion house.

Inside one of di fotos, wey be di first for series of fotos wey di singer share for one Instagram post, di newly weds bin pose next to one golden retriever.

Di post wey dem caption "M+M" bin follow one white heart and di ceremony date, 21 November.

Miley sister Brandi Cyrus, singer Doechii and fashion designer Donatella Versace dey among dos wey congratulate di couple for di comments.

According to tori, di ceremony happun for one resort formerly owned by Fly Me To The Moon singer Frank Sinatra.

Di American singer bin confam her engagement to di 28-year-old drummer during one interview wit US TV show Good Morning America last year.

She tok say Morando bin get down on one knee for di proposal during one trip to Asia.

"I no dey easy to surprise becos I dey love to control evri situation and I don completely surrender and I dey tell you, e surprise me well-well," she tok.

During one interview wit Wonderland, Morando tok say "im gatz dey really sneaky" to keep im proposal plans secret.

"We bin go Tokyo first for a couple days, from there we go Kyoto. I tink say she sense am say sometin wan happun, so I wait until di very last moment of di very last day so dat she no go notice," e tok.

Cyrus, wey be 33 bin don marry bifor, she marry Australian actor Liam Hemsworth butdi couplebin separate for 2019.

Di singer, wey her hits include Party for di U.S.A and Wrecking Ball, bin marry Hunger Games star Hemsworth for 2018 after di couple bin date for almost 10 years.

For one interview wit British Vogue for 2023, Cyrus toks she and 28-year-old Morando meet afta pipo "put dem on a blind date".

Morando na American drummer wit LA-based band Liily. Di band follow for di NBC Miley New Year Eve Party - wey Cyrus dey host - for 2022, alongside musicians wey include Cyrus late godmother Dolly Parton and David Byrne.

E also be songwriter, and music producer.

Who be Miley Cyrus

For 2024, Miley Cyrus bicom di youngest-ever star to receive Disney legend status.

Di singer bin rise to fame by playing di role of Hannah Montana for di Disney Channel series wey first show on air for 2006 wen she be 13.

She win her first Grammy earlier in di 2024 for Flowers, wey dem recognise as 2023 record of the year and e spond10 weeks for number one for UK.

Miley leave behind her Disney kid image wen she release her fourth album, Bangerz for 2013.

For dat same year, se bin do of duet of We Can't Stop wit Blurred Lines singer Robin Thicke for di MTV VMAs.