Who be di Ghana lawmaker wey dem detain for Amsterdam airport

Di lawmaker win di Asante Akyem North 2024 parliamentary elections wit ova 17,000 votes wey be di first time independent candidate dey pull such result for Ghana elections

Wia dis foto come from, OHENE KWAME FRIMPONG/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di lawmaker win di Asante Akyem North 2024 parliamentary elections wit ova 17,000 votes wey be di first time independent candidate dey pull such result for Ghana elections
Published
Read am in 4 mins

Ghana parliament don confam di detention of one lawmaker Kwame Ohene Frimpong for one airport for Netherlands.

Di 40-year-old businessman bin dey outside di kontri for one trip wen im chop arrest.

Clerk to Ghana parliament Ebenezer Djietror inside one statement confam di arrest wey im add say dem dey work to get more details about dis arrest.

"Parliament don become aware say dem bin detain di member of parliament for di Asante Akyem North constituency for di Schipol airport for Amsterdam."

Im add say "di speaker of parliament and leadership for di house dey in touch wit di Ghana mission for di Hague for more details for dis mata."

Di clerk of parliament also add say dem go "give di public updates for dis mata".

E no dey clear at dis point wetin cause di detention but dis no be di first time di lawmaker dey involved for tins wey relate to crime.

Di MP deny claims of fraud in di past

Inside one statement by di aide to di MP for 27 October 2025, dem respond to allegations say di lawmaker bin dey involved for fraud.

Di statement explain say "di office of di lawmaker don receive reports say some pipo dey use di MP name to defraud odas for one alleged travel and visa program."

Di aide Kelly Mensah add say "di MP Ohene Kwame Frimpong no get connection wit any travel or visa scheme wey im no also give anybody di authorization for such activities."

Dem add say wetin dey go round on top social media be scam so make pipo report to di police.

Later for 8 September 2025, lawyers for di first-time MP respond to allegations say im chop arrest wey im dey face trial outside d I kontri wey mean say im parliamentary seat for Asante Akyem North dey under threat.

Inside dat letter wey lawyer Elvis Adu-Ameyaw bin sign, dem deny di allegations.

"Our client categorically deny di allegation wey be false, baseless and malicious."

Dem add say "we gatz clarify say our client no dey face any pending legal proceedings whether civil or criminal for any court either for Ghana or oda places."

Di 40-year-old lawmaker don build mosque, schools, toilet facilities and oda tins for im constituency

Wia dis foto come from, OHENE KWAME FRIMPONG/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di 40-year-old lawmaker don build mosque, schools, toilet facilities and oda tins for im constituency

Profile of Ohene Kwame Frimpong

Ohene Kwame Frimpong wey first be member of di opposition New Patriotic Party (NPP) comot wey im stand for di 2024 elections as independent candidate for di Asante Akyem North constituency for di Ashanti region of Ghana.

Im win di parliamentary elections by ova 17,000 votes.

Di electoral commission results show say di NPP candidate Andy Appiah Kubi get 8,933 votes, di National Democratic Congress (NDC) candidate – Kofi Asamoah get 2,469 votes wey independent candidate – Ohene Kwame Frimpong get 26,926 votes.

Di results be di first time independent candidate win parliamentary election wit ova 17,000 votes.

Di businessman wey now turn politician dey popular for im constituency wey im begin to develop di constituency.

Im build mosque, markets, schools and oda businesses for im constituents, wey im promise say im go do more tins to develop di area.

Im decide to do business wit di govment party for parliament so say im go fit lobby di govment for more projects for di constituency.

Im be one of di first lawmakers wey decide to use im local language (akan) to deliver statement on di floor of parliament.

At dat time im tok say he decide to speak local language so say im constituents go understand wetin im dey tok for di floor of parliament.

According to parliamentary records, Ohene Kwame Frimpong attend di College of North East London wia im get Executive Diploma certificate.

Im also get anoda Executive Diploma certificate for di International Career Institute.

Ohene Kwame Frimpong dey part of di Roads and Transport committee for parliament wey im also dey part of di Standing Orders committee.