Who be di journalist Uganda Tooro Kingdom select as new king as controversy surround kingship

King Oyo and di successor wey Uganda kingdom select

Wia dis foto come from, ROBERTO SCHMIDT/AFP via Getty Images/UBC

Published
Read am in 7 mins

One traditional Ugandan kingdom don select one television news anchor as di successor to King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV, wey die last month at di age of 34.

But members of King Oyo immediate family, including im mama, Queen Best Kemigisa, and im sister, Princess Ruth Komuntale don reject di selection.

Di Babiito clan, wey be di royal clan of di Tooro Kingdom for western Uganda select Prince Edward Rukidi Kijanangoma on Wednesday, 10 September.

Dem make di announcement for Karuziika Palace for Fort Portal, di official residence of di Tooro monarch.

Msgr Isaiah Mayombo read di announcement on behalf of di Babiito clan for di presence of clan leaders and members of a 21-member succession committee.

Di committee tok say dem carry out consultations and due diligence bifor dem select Prince Kijanangoma as di pesin to succeed King Oyo.

Di committee decide say make Prince Kijanangoma, di son of di late Prince Christopher Paul Kijanangoma and grandson of di late Omukama George David Rukidi III, dey enthroned as di new King of Tooro.

Ugandan comment on Tooro kingdom kasala

Di Ugandan govment don tell pipo for Tooro Kingdom to remain calm as consultations kontinue ova who go succeed di late King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV.

Speaking during mourning ceremony for Karuziika Palace, for western Uganda on Thursday, Internal Affairs Minister, David Witonze acknowledge di kasala wey dey happun ova di succession of di 34-year-old monarch.

E call on pipo to wait for guidance from President Yoweri Museveni, who e describe as " The Chief Elder".

"Please remain calm and keep peace. But as we dey here struggling for di succession, can we please wait for di Chief Elder, and dat na His Excellency di President, to guide on wetin be di next step, " Witonze say.

Di comments come as rejection dey fly upandan ova who go succeed King Oyo, wey die last month afta more dan three decades on di throne.

Di body of di late King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV land Entebbe International Airport on September 4, 2026 for Entebbe, Uganda

Wia dis foto come from, Hajarah Nalwadda/Getty Images

Wetin we call dis foto, Di bodi of di late King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV land Entebbe International Airport on September 4, 2026 for Entebbe, Uganda

Prince Kijanangoma na news anchor and editor for Uganda Broadcasting Corporation (UBC), di kontri state broadcaster.

E don welcome di selection and acknowledge di decision. E post on im 'x' account say, "Tank you evrione for di congratulatory messages I dey get. We go work closely for di beta of our mighty Tooro kingdom. Once upon rest in peace my brother king Oyo Nyimba Kabamba."

Di announcement dey come as preparation continue for di burial of King Oyo, wey die on 27 August, as e dey receive cancer treatment for di United States.

Dem return im bodi to Uganda last week and dem go bury am for royal tombs near im palace on Saturday, 12 September.

King Oyo bicom di world youngest reigning monarch wen e inherit di Tooro throne for 1995 at di age of three.

Di selection don also spark debate on social media, as some users welcome di choice while odas don question di succession process.

Afta di announcement, Ugandan politician Mike Mukula tell UBC say di kingdom need clear and orderly succession process.

E say Tooro don successfully manage 13 previous transitions and e argue say di latest succession suppose follow di same established approach.

Late King family reject di successor

 Queen Mother Best Kemigisa and left, Princess Elizabeth Bagaya of Toro

Wia dis foto come from, Hajarah Nalwadda/Getty Images

But di late king family say di process don overlook im wishes.

Queen Best Kemigisa, di mama of di late King Oyo, don reject di announcement as she say di selection no reflect di wishes of her son or di royal family.

King Oyo sister, Princess Ruth Komuntale, also reject di decision as she say her late brother leave written will wey name im son as di heir.

She describe di development as disappointing and warn say e fit create division and kasala within di kingdom.

Di disagreement bin different from earlier statements by Tooro Prime Minister, Calvin Armstrong Rwomiire, wey tok say King Oyo leave one heir and di continuity of di crown dey assured.

Di selection committee however, maintain say dia decision follow consultations and dia mandate to identify suitable successor afta King Oyo death.

Di choice of Prince Kijanangoma also come as shock as earlier claims bin don dey ground say King Oyo get young son wey fit inherit di throne.

Late king mama cry out ova alleged house arrest

Queen Mother Best Kemigisa

Wia dis foto come from, Hajarah Nalwadda/Getty Images

Di mama of di late King Oyo Nyimba, Queen Best Kemigisa, say dem don withdraw royal guards from di palace.

She also say Uganda Army, UPDF don deploy sojas around di premises.

Dis dey come as di succession wahala for Tooro Kingdom continue to ginger. Queen Kemigisa bin challenge di selection of Prince Edward Rukidi Kijanangoma and she beg say make dem allow her family to mourn and bury King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV in peace.

For one statement issued on Thursday, 10 September, Kemigisa tok say di security deployment don restrict di royal family movement plus dia ability to receive visitors, as dem describe di situation as "house arrest".

"Now, three days to my son burial, General Kayanja Muhanga come to di Palace and e remove di royal guards witout notice, and dem deploy sojas around di Palace.," she tok.

Di Queen appeal to di army leadership and President Yoweri Museveni to allow di family to mourn and bury Oyo in peace.

"And now, wit di security deployment around di Palace, we no fit leave or receive pipo freely. We dey under house arrest. I appeal to General Kayanja Muhanga, Army leadership, and di president to allow our family di freedom and dignity to mourn and bury King Oyo in peace," she write.

"I appeal to dose wey dey fight ova di throne: please, time go dey for all of dat," she tok. "Let us grieve and bury my son King Oyo."

Kemigisa also say King Oyo leave one will wey outline im wishes, but dem no honour am, following di decision by di Ababiito clan succession committee to name Prince Kijanangoma as im successor.

Ugandan govment neva respond to BBC request for comments on di allegations.

Thousands of mourners dey expected to attend di burial for di royal tombs near di palace for Fort Portal for western Uganda.

Dem bin return im bodi to Uganda from di US on Friday, and preparations for di burial dey go on.

Who be di journalist wey dem name as King Oyo successor

Prince Edward Rukidi Kijanangoma

Wia dis foto come from, UBC

Dem select Prince Kijanangoma as di successor, but e neva dey formally enthroned as di King of Tooro.

56-year-old Prince Kijanangoma na news anchor and editor for Uganda Broadcasting Corporation (UBC), di kontri state broadcaster.

E be di son of di late Prince Christopher Paul Kijanangoma and grandson of di late Omukama George David Rukidi III.

Prince Kijanangoma also na cousin to di late King Oyo.

Bifor im selection as Omukama, e spend years working as journalist, and na familiar face to television audiences.

E dey present major news bulletins, wey include UBC News Tonight, while covering politics, courts, education plus oda national events.

Prince Kijanangoma generally keep im personal life away from di public spotlight.

Di succession panel bin initially consider andoda royal, UK-based Prince George Desmond Kamurasi for di throne but e dey rejected as dem cite responsibilities, according to di succession committee.

E neva dey clear yet wen di enthronement go take place, but di committee say dem go conduct am in accordance wit di traditions and customs of di Tooro Kingdom.

King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Tooro na one of Uganda traditional kingdoms. Although, dem say di monarch no get constitutional political power, di kingdom retain considerable cultural and social influence for western Uganda.

Uganda bin cancel dia traditional kingdoms for 1967, but dem restore dem back for di 1990s under President Museveni.

Dia monarchs dey recognised as cultural leaders rather dan political rulers.

President Museveni bin first make public di existence of Oyo son days afta di king death. Di Ugandan leader tok say di queen mama tell am about di young boy.

Till now, no oda official information don come out about di boy, and bifor dat time, nobodi bin present am publicly as di pesin wey go inherit Oyo throne.

Princess Komuntale tok say Oyo leave "veri strict instructions" on im succession, as e name im son as first in line and e also set out alternatives if di boy fit no take di throne - position wey her aunt, senior royal Princess Elizabeth Bagaaya, support.

But clan representatives tok say di reports say Oyo get son no dey sufficient bicos nobodi don formally present di boy to di royal clan as dictated by Tooro tradition.

One committee member tell Uganda NTV station say dem must formally introduce royal pikin to elders and den di pikin must undergo ceremonies and oda preparations if dem go dey considered for future leadership.