Nigerian political parties wey don announce dia presidential candidates for 2027 general elections

    • Author, Adesola Abisoye
    • Role, BBC News Pidgin
  • Published
  • Read am in 8 mins

Di Nigeria presidential election dey expected to hold for January 2027, all tins equal and political parties don dey announce dia flagbearers.

Across di kontri, major political parties don do dia primaries to elect who dia candidates go be, while some also adopt consensus.

Wit Independent National Electoral Commission (Inec) gearing up to receive names and details of evri eligible candidates from dia party for di 2027 general elections, di stage don set.

Political parties get small time to submit di candidate details so as to meet up wit Inec deadline.

From di ruling All Progressives Congress (APC), to Labour Party, Young Progressives Party (YPP), Africa Democratic Congress (ADC) and to di new Nigeria Democratic Congress (NDC) - candidate announcement dey circulate.

BBC News Pidgin chook eye to look some of di candidates wey dia party don alreadi announce and dose wey win as flagbearers to represent dia party for ballot during di 2027 presidential election.

All Progressives Congress (APC) - Bola Tinubu

Bola Tinubu na di incumbent president of Nigeria under di All Progressives Congress (APC) afta dem declare am winner of di last 2023 presidential election.

Again for 2027 election, APC don announce Tinubu as di winner of di presidential primaries wey make am di party flagbearer.

Oga Tinubu emerge victorious wit total of 10,999,162 votes, while im opponent Stanley Osifo secure 16,503 votes.

Asiwaju Bola Tinubu na former Lagos state govnor, southwest Nigeria.

Di two term govnor of Lagos bin also serve as senator during di brief third republic for Nigeria.

Dis go be im second time to contest di presidential election.

Na im party currently dey for office so dat one make dem di party to beat.

Im vice presidential candidate for 2023 na former Borno State govnor Kashim Shettima - e possible say e go maintain am like dat or change running mate.

Africa Democratic Congress (ADC) - Atiku Abubakar

Atiku Abubakar na di flagbearer of Africa Democratic Congress (ADC) for di 2027 presidential election.

During di primary, Atiku get total of 1,846,370 votes, to defeat im rivals, former Rivers State govnor Rotimi Amaechi (504,117) and businessman Mohammed Hayatu-Deen (177,120).

Atiku na man wey don tey for politics. Im don attempt to be president several times for different political parties.

Im be former Vice President of Nigeria and PDP Presidential Candidate for 2023 election wia e come second.

2027 go be about di seventh time wey Atiku go seek to become Nigeria president afta e first show interest for 1993 even though e no get im party ticket at di time.

Di Adamawa State-born businessman contest general elections for 2007, 2011, 2019 and 2023 elections.

We dey expect who Atiku go announce as im running mate.

Nigeria Democratic Congress (NDC) - Peter Obi

Peter Obi na former govnor of Anambra State for southeastern Nigeria wia im get strong record. E also get active support base for social media.

Im be former candidate of di Labour Party for di 2023 general elections wit im vice Yusuf Baba-Ahmed, wey be former senator from Kaduna State.

Dis go be di third time wey di former two-term govnor go dey ontop presidential ticket as e serve as running mate to Atiku Abubakar of di PDP for 2019 elections, and presidential candidate for 2023, and now for anoda party as flagbearer.

Obi first comot Labour Party to join ADC, bifor e later come go NDC.

Obi announce former Kano govnor Rabiu Kwankwaso as im running mate, during di party special convention.

Young Progressives Party (YPP) - Anita Zugwai-Chukwu

Di Young Progressives Party (YPP) announce a female as dia presidential candidate for di 2027 general elections.

Mrs Anita Zugwai-Chukwu na di party sole presidential candidate for di 2027 general elections. Dem announce am during dia third national convention wey hold for Abuja.

E be dia National Women Leader, and also hold some oda positions.

Zugwai-Chukwu emerge unopposed for di convention wia party leaders and members cast dia vote to make her di presidential flagbearer for di party ahead of di next general elections.

Allied Peoples Movement (APM) - Seyi Makinde

Oyo State Govnor Seyi Makinde become di presidential candidate for Allied Peoples Movement (APM) for 2027 general elections.

Dem announce am during di Presidential Primary Election and Unveiling Ceremony wia party members and stakeholders endorse am as di party presidential candidate for di 2027 general elections.

E become elected Govnor of Oyo State on 10, March 2019, and later re-elected for anoda four years.

Bifor e enta politics, e be engineer and businessman wia e serve as Group Managing Director of Makon Group Nigeria Limited, wey e create.

Makinde say im vision as President of Nigeria na to work to reform national security architecture so dat states no go dey helpless for moments of crisis.

E neva announce any running mate.

Labour Party (LP) - Kennedy Ahanotu

Di Labour Party faction led by Julius Abure don adopt Prince Kennedy Ahanotu as di party presidential candidate for di 2027 presidential election.

Ahanotu na di National Youth Leader of di party but e don become di presidential flagbearer.

Prince Kennedy pull total vote of 2,944,420 through consensus primary election.

"I proudly accept di nomination of our great party, di Labour Party, as dia Presidential Candidate for di 2027 General Election," e tok for im acceptance speech.

However, di faction led by Nenadi Usman, also unveil dia own candidate, Chibuzo Okereke, who dem tok say e emerge by consensus on 30, May 2026.

Okereke na governance expert, policy strategist and reform advocate, according to wetin di LP faction tok, and e also be lecturer for di Department of Public Policy and Administration, for Miva Open University, Abuja.

Peoples Democratic Party (PDP)

For Peoples Democratic Party (PDP), some internal crisis still dey go on as di party still dey divided into two factions, and di two groups don nominate presidential candidate each.

On Tuesday, 26 May 2027, di PDP faction wey di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, dey support, nominate one former senator, Sandy Onor, as dia consensus presidential candidate.

For di event for di PDP national secretariat for Abuja, chairman of dia screening committee, Samuel Ortom, tok say Onor na di outstanding candidate wey dem sure say e go take di party to victory.

Anoda faction say dem wan affirm former president Goodluck Jonathan as dia candidate.

African Action Congress - Omoyele Sowore

Di African Action Congress (AAC) bin officially fix Tuesday, May 26, 2026, for dia presidential primary election ahead of di 2027 general elections.

During di primary election, Omoyele Sowore emerge as di presidential candidate for AAC.

Omoyele Sowore na journalist, human rights activist wey bin don follow contest for Nigeria presidential election.

E don chop plenti arrest and detention ova di years.

Im be di RevolutionNow leader for Nigeria and publisher of Sahara Reporters news platform.

Nigeria govment bin arrest Sowore for August 2, 2019 say im commit treason.

Dem later release am for 5, December afta e spend more dan three months for detention, only to re-arrest am inside court less dan 12 hours later.

On 13 December, 2019, Attorney General of Nigeria and Minister of Justice, Abubakar Malami bin take ova di case of Sowore from di kontri Department of State Services.

According to AAC, na 34,522 registered active members dem get across Nigeria.

Social Democratic Party (SDP)

Nigerian politician and lawyer Adewole Adebayo na di presidential candidate of di Social Democratic Party (SDP) for di 2027 general elections.

Di party bin submit im name give di Independent National Electoral Commission (Inec) as di presidential flagbearer of di party for di election on 9 May.

SDP say for di convention and direct primary election wey dem conduct peacefully and successfully for Abubakar Tafawa Balewa Stadium, Bauchi, Adebayo bin emerge as di sole aspirant and e secure majority support from delegates and party members.

Meanwhile, di presidential candidate say im join di race becos Nigeria must dey rescued from hunger, homelessness, joblessness, insecurity, and leadership failure.

"Nigeria no be private company. Nigeria belong to Nigerians. Dis movement no be about one man. Na about restoring hope, defending democracy, and giving di Nigerian pipo a govment wey truly work for dia interest," Oga Adebayo tok.

People's Redemption Party

Former govnor of Cross River State, Donald Duke, na di presidential candidate of di People's Redemption Party (PRP).

Di primary election bin hold on 27, May 2026, and according to di result announced by di PRP national chairman Hakeem Baba-Ahmed, Duke gada 6,499 votes to defeat im opponent Kingsley Yakubu, wey only get 2,699 votes.