Nigerian actor Taiwo Hassan Ogogo don die afta battle wit stage 4 cancer

Taiwo Hassan

Wia dis foto come from, @ogogotaiwohassan/Instagram

Published
Read am in 5 mins

Veteran Yoruba actor Taiwo Hassan wey pipo sabi well well as Ogogo don die at di age of 66.

Ogogo battle stage 4 cancer for several weeks bifor di news of im death begin trend.

Im colleague Jide Kosoko announce and confam di death of Ogogo on Sunday.

"Wit heavy hearts and profound sadness, we announce di passing of ALHAJI TAIWO HASSAN, popularly known as OGOGO, wey pass away at 3:00 p.m. today Sunday, 23rd August 2026. At 66 years," Jide Kosoko write for im Instagram page.

Meanwhile, for Sunday afternoon, one of Ogogo daughter, Kira Taiwo don make Instagram live video wia she begin dey cry say her papa don die.

For di video, e show her face wit tears as she dey tok say her papa don die, while anoda voice dey calm her down for di background.

Di nollywood actor begin trend on Monday, 17 August, 2026 afta im daughter Kira Taiwo cry for video wey don dey go viral on social media say im papa bin dey struggle wit stage 4 cancer.

She beg say make fans and loved ones help find better health solutions to di condition. Dat one make colleagues for di movie industry dey pray for im recovery.

According to Jide Kosoko, wey dem gada act feem togeda well well, e say dem go carry Ogogo body go im hometown.

"Im remains go go im hometown, Ilaro, Ogun State today wia di Laying-in-State Ceremony go take place tomorrow Monday, 24th August 2026"

Taiwo Hassan alias Ogogo

Wia dis foto come from, @ogogotaiwohassan/Instagram

How Taiwo Hassan Ogogo battle stage 4 cancer

"I no want my papa to die," dis na some of di words from Kira for di viral video as she say hospitals wey dem carry her papa go, no gree treat am again.

She bin ask di public if dem know anybody or facility wey fit treat her papa to reach out to dem.

"I dey hia to ask for help for my papa, im get cancer and e dey really really bad. Many hospitals no gree treat am, at least, abeg make una give dis man chance.

"Nobody wan do anytin, we no dey ask for money, if you know pesin wey know pesin wey fit treat am, make una help," she tok.

Im daughter add say she no fit imagine say her papa go die and add say wetin dey pain her pass be say her papa get strong will to live.

"Dis man get strong will to live. If you see am you no go even know say somtin dey wrong wit am wey bad well-well, e just start to dey show."

According to Kira, di cancer just begin show and na three weeks ago dem diagnose am of di life-threatening disease.

"We bin no even know untill like three weeks ago, so abeg, I dey beg una, if you know pesin wey know anoda pesin wey go fit treat am, we dey ready to try anytin, abeg we no dey hia to ask for money."

She add say her papa dey suffer from stage four cancer and her big uncle na im dey help wit di hospital bills since dem notice say im get cancer.

"I no want make my papa die, hospital dey tok say dem no go fit treat am again.

"I no dey here to beg for money," di actor daughter tok.

Taiwo Hassan

Wia dis foto come from, @ogogotaiwohassan/Instagram

Who be Taiwo Hassan?

Taiwo Hassan na Nollywood actor, wey dey popular for im multiple roles for di Yoruba feems.

Im don dey act for veri long time and na face wey pipo wey dey watch feem well-well fit recognise.

Ogogo na 66 years old and na ogbonge actor for Nollywood. Di actor also dey known for im beautiful voice wen e dey chant.

E come from di family of twins. Im forefather na Taiwo, di one wey follow am na Taiwo, im papa na Taiwo and im mama give birth to twins four times.

Ogogo na di last of im parents twins wey kpai. Im parents born thirteen pikin dem wey remain three.

Ogogo na trained boxer wey no dey hide im boxing skills.

Di actor bin battle chronic ulcer for six to seven years wey bin nearly take im life.

Im best friend na Yinka Quadri – e say no friend wey im don eva love like dis fellow actor.

'Na all of us go chop breakfast' na famous Ogogo line for one Yoruba movie wey become street slang.

Tori be say im acting career don pass forty years and im don act ova 300 feems for Yoruba. One of di ogbonge feems wey im act and wey blow well-well na Owo Blow wey dem release for 1996 and directed by Tade Ogidan.

Pipo also sabi Ogogo as pesin wey get action inside feems wit di way e dey act, im aura and how e dey carry imsef. Na dis im action create di Yoruba street slang, 'Action Po bi Ogogo,' wey mean 'Action Plenty like Ogogo'.

Screengrab announcing death of Ogogo

Wia dis foto come from, Jide Kosoko

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post