As E Dey Happen, Ekiti 2026 govnorship election live as 14 candidates dey battle for one seat

Di pipo of Ekiti dey vote for di state govnorship election as di current Govnor Biodun Oyebanji go end for 15, October 2026.

Summary

Live Coverage

Tunde Ososanya and Adebola Ajayi

  1. ADC candidate Oluwadare Bejide driver chop beating for polling station

    Kasala burst for one polling unit and di driver of di ADC govnorship candidate for di Ekiti State poll, Oluwadare Bejide, chop beating.

    Video wey dey circulate online show as dem wrap bandage for im head wey dey bleed.

    Inside di video, di driver say dem knack am gun butt for head.

    Bejide say na vote-buying cause di kasala.

  2. Govnor of Ekiti State Biodun Abayomi Oyebanji cast im vote

    Ekiti State Govnor, Biodun Abayomi Oyebanji as e dey cast im vote
    Wetin we call dis foto, Foto of Biodun Abayomi Oyebanji

    Ekiti State Govnor Biodun Oyebanji don cast im vote for PU 003, RA 06 Ekiti West.

    Di govnor tell residents say make dem dey patient as Inec dey do evritin to make sure say di electoral process dey peaceful and smooth.

    "Evritin dey positive, and di election dey go on smoothly. Di pipo dey happy, and voter turnout dey impressive," di govnor tok.

    "We dey satisfied. However, I need to appeal to our pipo make dem remain patient wit Inec. "All of dis technical glitches, Inec don personally assure me say dem go handle am."

    Ekiti State Govnor, Biodun Abayomi Oyebanji as e dey cast im vote
    Wetin we call dis foto, Foto of Biodun Abayomi Oyebanji
    Ekiti State Govnor, Biodun Abayomi Oyebanji as e dey cast im vote
    Wetin we call dis foto, Foto of Biodun Abayomi Oyebanji
  3. Former govnor of Ekiti Ayodele Fayose caste im vote

    Former Ekiti State govnor Ayodele Fayose don cast im vote for im Polling Unit 1, St. David Primary School, Afao-Ekiti, Irepodun/Ifelodun Local Govment Area of Ekiti State.

    Ayodele Fayose as e cast im vote for im polling unit for Ekiti
    Wetin we call dis foto, Foto of Former governor Ayodele Fayose
    Ayodele Fayose as e cast im vote for im polling unit for Ekiti
    Wetin we call dis foto, Former governor Ayodele Fayose
  4. How security officials tanda for Ekiti govnorship election?

    Heavy security tanda for Ekiti State for di ongoing govnorship election.

    BBC observe say heavy security presence dey for road, streets and polling units across di state on Saturday.

    Security officers carry weapons as dem dey at alert to counter any gbege wey fit happun for di election.

    Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) also dey on ground to combat vote-buying.

    Security officers
    Wetin we call dis foto, Foto of Nigeria Police Officers
    Security officers
    Wetin we call dis foto, Foto of Nigeria Police Officers
    Police officer on Uniform

    Wia dis foto come from, Nigeria office force/X

    Wetin we call dis foto, Foto of Nigeria Police Officers
    EFCC officials
    Wetin we call dis foto, Foto of EFCC officials
    EFCC officials
    Wetin we call dis foto, Foto of EFCC officials
  5. Isan-Ekiti incident no dey related to election violence - Police CP Shogunle

    Abayomi Shogunle

    Wia dis foto come from, Abayomi Shogunle/X

    Wetin we call dis foto, Foto of di commissioner of police for di 2026 Ekiti State govnorship election

    Di Ekiti Police Command on Saturday say di reports on di gbege wey happun for Isan-Ekiti no dey connected to di ongoing govnorship election as di mata happun from one community football match on Friday.

    On Saturday morning, many residents bin dey fear as report spread say two police officers die for di attack as youths begin fight on Friday night to protest against vote-buying ahead of di Saturday poll.

    Abayomi Shogunle, di commissioner of police for di 2026 Ekiti State govnorship election on Saturday ontop X, say di incident wey happun on Friday night for Isan-Ekiti community, Oye Local Govment Area of Ekiti State na becos of football match.

    Shogunle tok say police officers don contain and de-escalate di tension, as voting continue for di state on early mor-mor on Saturday.

    "Di gbege wey happun for Isan-Ekiti last night no be election/political related. Na becos of di football match for di community," Shogunle tok.

    "Necessary containment and de-escalation measures don dey in place, dem don restore calmness. Voting go still hold dis morning for di town as scheduled," e add

    Shogunle no tok about if two police officers die or not.

  6. PDP candidate cast vote, protest against alleged voters harassment

    Wole Oloyede cast his vote

    Wia dis foto come from, Olabode Olalekan

    Wole Oluyede, Peoples Democratic Party (PDP) govnorship candidate for di ongoing Ekiti Election, don cast im vote for ward 2, unit 3, Osagburu Hall, Ikere Local Govment Area.

    Oluyede allege say police officers dey harass members of im political party, block voters from accessing dia polling units for di community

    E also allege say di “heavy deployment” of police officers for im community too much.

    Oluyede say dis afta im cast im vote for polling unit 06 for Osagburu/Hall Oke Oloti, Ward 03 Ugele Arokun for Ikere Ekiti.

    "Di process dey useless. Pipo don dey here for about one and half hours, and na only five pipo don vote for my polling unit. Dis na wetin dem dey do all di time. I dey suspect say somtin dey wrong wit di Inec process," Oluyede tok.

    "I go stay around. If dem dey vote five per hour, e dey sad. You no fit disenfranchise dis pipo. Dem deserve democracy. I dey confident say pipo go tanda for here to see di process. You fit go down dia make you see di army or police officers wey dey harass pipo. I get evidence to show."

  7. Police deploy officers, release hotline for Ekiti govnorship election

    Foto of police IGP, Disu Olatunji

    Wia dis foto come from, Nigeria Police Force/X

    Wetin we call dis foto, IGP Disu Olatunji

    Di Nigeria Police Force don intensify dia security presence and release emergency contact lines for di 2026 Ekiti govnorship elections.

    Inside one memo wey dem release on Saturday, di police say dem don deploy adequate officers, resources across di state to ensure peaceful, secure, and credible election.

    Di secuirity agency tell citizens say make dem follow election rules and report any emergencies.

    "Make citizens conduct demsefs peacefully, obey electoral guidelines, and report any suspicious activities to security agencies," di police tok.

    Election emergency line: 080062335577

  8. Candidates wey dey contest for di Ekiti State govnorship election

    Biodun Oyebanji, Wole Oluyede and Oluwadare Bejide

    Wia dis foto come from, Biodun Oyebanji, Wole Oluyede and Oluwadare Bejide/ Facebook

    Wetin we call dis foto, Foto of di top contenders

    Na 14 candidates dey for dis election, including di incumbent Govnor Biodun Oyebanji.

    Inec say Ekiti get 1,059,360 registered voters. Dis number increase by 66,000 compared to di number of registered voters for di last election wey happun for 2022.

    Who be di candidates?

    1. A

    Govnorship: Falegan Opeyemi David

    Deputy-Govnorship: Omoyeni Bayode

    2. AA

    Govnorship: Omotosho Matthew Olu

    Deputy Govnorship: Ayodeji Olumide George

    3. AAC

    Govnorship: Akande Oluwasegun Samuel

    Deputy Govnorship: Fajuyigbe Oluwasanmi John

    4. ADC

    Govnorship: Belloje Oluyindare Patrick

    Deputy Govnorship: Babatola Ayodeji

    5. ADP

    Govnorship: Ojo Ayodele

    Deputy Govnorship: Isitoye Itunu

    6. APC

    Govnorship: Oyebanji Abiodun Abayomi

    Deputy Govnorship: Afuye Monisade

    7. APM

    Govnorship: Anifowose Joseph Olanrewaju

    Deputy Govnorship: Ilesanmi Margaret Adenike

    8. APP

    Govnorship: Awogbemi Bidemi Olaiya

    Deputy Govnorship: Adewumi Akinyemi

    9. LP

    Govnorship: Olajuyin Ikuasayedegbe Oyehanji

    Deputy Govnorship: Okumade Ayokunle Odumayo

    10. NNPP

    Govnorship: Abegunde Ayodami Blessing

    Deputy Govnorship: Ajayi Francis Ade

    11. PDP

    Govnorship: Oluyede Olumayokun Oluwole

    Deputy Govnorship: Ogunsakin Kazeem Ayodeji

    12. PRP

    Govnorship: Ayodele Olaniyi Olanrewaju Praise

    Deputy Govnorship: Adebiyi Modupe Dorcas

    13. YPP

    Govnorship: Osinkolu Olusegun Ayodele

    Deputy Govnorship: Arowolo David Olusesan

    14. ZLP

    Govnorship: Adetunji Victor Damilola

    Deputy Govnorship: Oyeniyi Adesina Charles

  9. Voting don start!

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    Voting don start for di Ekiti State govnorship election as electoral officers keep to time wey di poll suppose start wey be 8:30am.

    Pipo comply to di ‘no movement order’ as di roads dey empty.

    People queuing to vote
    A woman voting
  10. Una good morning

    Dis na our live coverage of Ekiti govnorship election wia 14 candidates dey contest for di poll.

    Our tori pipo dey for Ekiti State to bring una all di informate as e dey happun for di election.

    Dis live page go dey open until election finish.