APC state assembly primaries: Barakat Odunuga-Bakare, Orode Uduaghan... Who be di big winners and losers?

Wia dis foto come from, Barakat Odunuga-Bakare/Orode Uduaghan/Ganiyu Egunjobi/Desmond Elliot/Facebook
Di All Progressives Congress (APC) primary elections for aspirants wey wan contest for seats into di various State Houses of Assembly don come and go and results don also come out.
Observations by BBC News Pidgin show say na consensus arrangement be di order of di day for majority of di states, while di places wia election actually take place na mostly aspirants wey get di endorsement of di state govnors win.
As e be now, winners for di primaries don praise di process as free and fair and a good reflection of internal democracy for di APC, but di pipo wey lose dey lay accuse say malpractice plenti for di election.
Hia na some of di big names wey emerge winners and di ones wey evriwia still blur for dia eyes:
Di big winners...
Barakat Odunuga-Bakare: APC officials for Surulere Constituency 1 for Lagos State declare Barakat Odunuga-Bakare winner of di primary election wit 11,385 votes.
Odunuga-Bakare bin run against di incumbent Desmond Elliot wey bin refuse to honour di consensus arrangement of di party.
Afta insisting say e must contest di primaries, Nollywood star Desmond Elliot later tok say e dey withdraw from di process as e allege say dem no allow im supporters enta di election venue.
"For all di zones, dem dey intimidate and stop us. I wan officially announce my withdrawal from dis particular race. Na my ward be dis, if you go outside you go see my pipo, dem no allow dem enta," oga Elliot tok.
Tori be say Desmond Elliot offend im big oga, Femi Gbajabiamila - di current Chief of Staff to President Bola Tinubu. But even though di actor later apologise, e appear say im apology no work.
Ganiyu Egunjobi: dis former Chairman of Agege Local Govment Area for Lagos State, na di consensus candidate to fill in di vacant seat wey di former Speaker of di Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, go comot from.
Obasa don hold down di Agege Constituency 1 seat for more dan ten years, but e decide to move up to di Federal House of Representatives for 2027, and e don already secure im own ticket.
For almost all di oda state constituency primaries for Lagos State, na consensus method dem use and di anointed aspirants win.
Orode Uduaghan: For di Warri North Constituency seat for Delta State, Orode Uduaghan, di daughter of di former govnor of di State Emmanuel Uduaghan, na she win di ticket, also by consensus arrangement.
Abdulkarim Lawan: Di Borno State House of Assembly Speaker easily win im ticket to return as di representative for Guzamala constituency.
If e win di election proper and also get elected as Speaker, e go be di longest serving State Assembly Speaker for Nigeria, as dat go be im fifth term.
For kontri wey get four-year election cycle, e go mean say oga Lawan don be Speaker for 20 years.
Uzodinma boys: For Imo State, e no be surprise say na consensus arrangement work for all di state constituency seats, and all di aspirants get di support of di State Govnor Hope Uzodinma.
Di same tin also happun for Rivers State wia di aspirants wey get di backing of former govnor Nyesom Wike, win di primary elections.
Even though Wike imsef no be member of APC, many pipo believe say e dey work for di party. Im party, di Peoples Democratic Party (PDP) dey still struggle to survive sake of plenti internal wahala.
Di big losers...
Desmond Elliot: Di Nollywood actor-turned politician tok say e withdraw from di Surulere Constituency 1 contest, but dem still allocate 270 votes to am according to di results wey di APC officials later announce.
Im rival, Barakat Odunuga-Bakare get 11,385 votes to win di ticket.
Atu Osawonyi: Di current deputy speaker of di Edo State House of Assembly lose im ticket for di Ikpomwonsa Aitusi Constituency seat to im challenger Ikpomwonsa Aitusi.
Osawonyi na just one of di many sitting members of di Edo Assembly wey lose dia tickets to return to dia seats.
Di odas include:
- Yekini Idiaye, a former Deputy Speaker of di Assembly, wey lose im Akoko-Edo I Constituency ticket to Humphrey Adewunmi
- Uyi Omosigho lose im Oredo East Constituency ticket to Osamuede Edebiri
- Asonsere Nicholas lose im Ikpoba-Okha Constituency ticket to Ndidi Aghimien
- Bright Iyamu lose im Orhionmwon South ticket to Etinosa Odiase
Hyacinth Dajoh: Di immediate past Speaker of di Benue State House of Assembly, also tok say e dey withdraw from di primaries.
Oga Dajoh tok say di primary election exercise for im Gboko West Constituency bin dey full of irregularities and transparency no dey, but political pipo tok say Dajoh bin no get any chance bicos e no get di support of di govnor.









