You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How US President Trump take 'sneak' comot for Turkey afta assassination threat from Iran
Donald Trump secretly swap planes as e leave one Nato summit for Turkey last month in response to one possible Iranian threat, US media report.
Di US president bin board di Air Force One for di front of television cameras bifor dem smuggle am inside one elevated airport catering truck and carry am inside one military aircraft, tori pipo and some White House staff wey dey on board no know, di Washington Post tok.
Officials bin tell US partner CBS News say di bin get one ogbonge informate say Iran dey threaten to fire missile for di plane.
Di White House neva confam di secret switch.
Trump earlier don tok say im be Iran "number one target" during di summit for Ankara.
Di secret move bin come one day afta US renewed military strikes on Iran following di breakdown of negotiations between Washington and Tehran to end di war.
Trump earlier don tok say im be Iran "number one target" during di summit for Ankara.
Di secret move bin come one day afta US renewed military strikes on Iran following di breakdown of negotiations between Washington and Tehran to end di war.
Trump land Turkey aboard one newer Boeing 747-8 wey Qatar donate, but e announce say im go leave di kontri on di old Air Force One "for old time sake".
On 8 July, video show as e board di presidential jet for Ankara airport. But according to di Washington Post, dem later carry am to one smaller C-32A military aircraft - one modified Boeing 757 wey di vice president often dey use - via one catering truck wey dem don elevate to plane level wey bin dey di opposite side of im plane.
Defense Secretary Pete Hegseth bin board di C-32A separately, e use one external stairs to make di flight appear normal, according to di newspaper.
According to reports, dem tell tori pipo and some White House staff wey dey Air Force One to close dia window shades. Dem no know say di president no dey on board di plane again.
Trump come fly go UK en route to di US, wia e enta di old Air Force One and pipo see as e dey descend from di aircraft afta e land for RAF Mildenhall.
E neva dey clear how e move from di C-32A go back di legacy jet.
Dem later transfer di president to di new Qatari-donated Air Force One to travel go back Washington.
During dat flight, Trump follow tori pipo wey dey on board tok, e tell dem about threats by Iran but e no mention di earlier plane swap.
Wen tori pipo ask say wetin be di reason why dem tell dem to close dia window shades on di plane from Turkey, Trump say: "Na bicos you probably dey on a dangerous flight sake of di sleazebags we gatz deal wit."
E dey always say e dey get "threat all di time" on im life, and say e be "number one" on Iran "list".
White House communications director Steven Cheung no directly confam or deny di reports, but e say di new Air Force One na "state-of-the-art aircraft" wey get security measures to protect di president and im staff.
US intelligence previously don warn of specific threat of an attack on Trump or im aircraft, according to earlier reporting by CBS News.
New York Times previously too bin report security concerns on top do Qatari jet dem give US as gift.
Na di Secret Service advise Trump to switch planes on im return from di Nato summit.
For plenty of di reports, dem call tori pipo to testify under oath in response. Di Justice Department tell BBC say dem dey investigate illegal leaks.
US spend months dey put advanced security measures and features for inside di $400m Boeing 747-8 to prepare am for di president.
Di older Air Force One planes get laser technology to blind incoming missiles, sources bin tell CBS News. E no clear di systems di Qatari jet get.
"Di new Air Force One dey perfectly safe for di President travels but go receive additional upgrades and enhancements for di fall which wey go approximately one month to complete," White House press secretary Karoline Leavitt bin tok for statement to CBS News.