'We go avenge di blood of our leader' - Iran supreme leader call for revenge ova father death

Man and woman on motorcycle pass large portrait of Supreme Leader Ayatollah Mojtaba Khamenei on street in Tehran.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Mojtaba Khamenei neva show for public since di conflict start for February
Published
Read am in 4 mins

Iranian Supreme Leader Ayatollah Mojtaba Khamenei don call for revenge for di death of im father and predecessor Ali Khamenei.

Vengeance na di "will of di nation", e tok for di written statement wey dem read out on state TV.

Na im first public message since im father funeral ceremonies begin.

Dem kill im father Ali Khamenei for air strike on 28 February, di first day of di US-Israeli war against Iran.

Many Iranians wey take part for di funeral ceremonies ova di past few days carry placards as dem call for di killing of US President Donald Trump.

Trump on Saturday warn say any of such plans go see di US "decimate and destroy all areas" of Iran in response.

Dem neva see im son for public since bifor di war, and e dey rumoured say e dey disfigured for di strike wey kill im father.

But di statement on Saturday dey clear say Iran dey determined to take revenge on di death of dia leader.

"We pledge to avenge di blood of di martyred leader and all di martyrs of dis two wars from di criminal and disgraced killers," Mojtaba say.

"Di matter no depend on my personal existence nor on dat of oda officials. Weda we dey present or not, e go come to pass."

Mourners gada for di burial of Iranian Supreme Leader Ali Khamenei for Mashhad. Many dey carry red flags wit Arabic script and for di centre na man hold picture of sitting Khamenei, wit im son Mojtaba standing above am.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Call for di assassination of Donald Trump dey heard at funeral ceremonies for Ayatollah Ali Khamenei for Mashhad

Wall Street Journal and oda US media report dis week say Israel don share intelligence wit Washington say Iran recently get plan to assassinate di US president.

Howeva, Trump deny say Tehran make fresh plan or say Israel na di source of any intelligence. E tell di New York Post for interview say e be "No. 1 [on Iran kill list] for a long time".

Wetin we call dis Video, Fire blazes in Iran after "powerful" US strikes

Di war begin wit US and Israeli attacks on 28 February, prompting Iran to attack Israel and US targets and allies for di Gulf.

For June, di US and Iran sign ceasefire agreement, to facilitate tok to end di war.

Earlier dis week, three commercial tankers dey attacked as dem try to cross US-recommended route through Omani waters.

Iran don repeatedly say di only "safe" route na separate route through dia waters.

Di incident prompt series of US strikes wia 17 dey among dose wey dey killed and 115 injured, according to Iranian officials.

Iran respond wit strikes on US allies for di Gulf.

Di exchange raise tensions and prompt Trump to declare di ceasefire ova.

Howeva, di US leader say tok go kontinue and mediators don try to revive di process.

US officials say dem don convey through mediators di demand wey Iran publicly state say di Strait of Hormuz, vital international shipping route, dey open and pledge to stop firing on commercial ships.

According to US media, Iran tell American officials di attacks on tankers na mistake and blame rogue internal group.