You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Dozens die for Saudi Arabia and France air crash
Fourteen pipo die wen one helicopter crash for Saudi Arabia, state media report on Sunday.
Di helicopter wey belong to di state oil giant Aramco, crash for di eastern coastal city of Ras Tanura at 06:00 local time (03:00 GMT). E kill evribody on board, according to di Saudi Press Agency.
All 14 victims na Saudi citizens according to di report.
Dem say investigation dey underway to determine di cause of the crash.
Aramco neva comment.
Di Saudi energy ministry don share dia condolences wit victims' families.
Ras Tanura na home to one major Aramco oil refinery - one of di largest for di Middle East.
Di Reuters news agency report say di company bin resume crude oil loading for di site on Friday, afta dem pause almost four-month pause sake of di war for di Middle East.
Eleven skydivers die as plane crash for eastern France
Eleven pipo don die afta one civilian aircraft wey carry skydivers crash for di town of Tomblaine for eastern France, local authorities tok.
Di pilot plus 10 passengers for di incident. Di victims na five students and five instructors, according to local officials.
Di plane wey one parachutist school dey use, bin take off from Nancy-Essey airfield wen e crash, local media report.
Police don ask di public to avoid di area around di airport for di Meurthe-et-Moselle department.
French transport minister Philippe Tabarot say im and interior minister Laurent Nunez dey travel go di scene of di crash, wey e call "terrible tragedy".
Yves Seguy, di prefect of di eastern department of Meurthe-et-Moselle tok say no bystanders injure for di incident, according to AFP news agency.
Di crash take place for one built up area near one shopping centre, AFP report.
"Di plane fall almost vertically, for di immediate vicinity of one housing estate, on di edge of di airfield," Seguy tell French broadcaster BFM. E add say na luck say more pipo no die.
Half of di skydivers wey die na nurses, Thierry Pechey, president of di Meurthe-et-Moselle branch of di Order of Independent Nurses, tell BFM.
Local officials also say relatives of di victims bin dey present for di airfield wen di crash happun.