Scotland vs Morocco Fifa World Cup 2026 match preview

John McGinn (7) of Scotland dey celebrate afta e score a goal during dia 2026 FIFA World Cup match against Haiti
Achraf Hakimi (2) of Morocco dey run wit tdi ball during di FIFA World Cup 2026 match against Brazil

Wia dis foto come from, Anadolu, Kevin C. Cox via Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Scotland go face Morocco for one important Round 2 Group C match for Fifa World Cup on Friday for Boston Stadium, as both teams dey come into di game afta good results for dia first matches.

Scotland go try build on top dia 1-0 win against Haiti wey be dia first World Cup victory in 28 years as dem go face Morocco for Boston Stadium on Friday. But e no go easy against di North African kontri.

For Morocco, di Scots go meet one team wey don prove say dia success no be luck. Afta reaching di semi-finals and finishing fourth for Qatar four years ago, dem continue to show class. Dem nearly beat Brazil last week and even outplay di five-time world champions. Now dem dey find di victory wey go secure dia place for di knockout stage.

Morocco start strong and fast against Brazil, so Scotland go need hold bodi well at di beginning so dem no go fall behind early. If Steve Clarke team fit remain competitive for long, e fit give dem chance to play dia own game and search for beta result.

Di right side partnership of Achraf Hakimi and Brahim Díaz dey make Morocco veri dangerous, while teenage midfielder Ayyoub Bouaddi don already begin shine as one of di breakout stars of di tournament.

If Scotland fit beat Morocco, e go put dem for strong position to qualify for di World Cup knockout stage for di first time in dia history.

But dem go need perform at dia veri best against one Morocco side full of talent, including one of di best right-backs for di world, Achraf Hakimi, Real Madrid star Brahim Díaz, young sensation Ayyoub Bouaddi and Ismael Saibari, wey score against Brazil.

Match prediction

Possible Scotland Starting XI:

Gunn; Hickey, Hendry, Hanley, Robertson; Gannon-Doak, Ferguson, McTominay, McGinn, Christie; Adams.

Possible Morocco Starting XI:

Bono; Hakimi, Diop, Riad, Mazraoui; El Aynaoui, Bouaddi; Diaz, Ounahi, El Khannouss; Saibari.

Di match go start by 11:00pm BST on Friday, 19 June.