Five key lessons Inec mock accreditation exercise reveal about commission readiness for 2027 election

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don test dia electoral technology and operational readiness ahead of di 2027 general elections through one nationwide mock accreditation and voting exercise.
Di exercise, wey dem carry out on Saturday, 28 November across selected polling units across di kontri na to assess di how di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) take dey function, test accreditation procedures and to know how prepared di commission dey for di forthcoming general elections.
BBC News bin cover some polling units across Lagos, FCT, Kano, Oyo, states among odas and report say di exercise record low voter turnout for some areas, electoral officials and materials no reach some polling units early, lack of communication between di commission and di voters, also some polling units experience technical challenges wey affect di accreditation process.
Dis na some of di lessons from di exercise.
Low turnout across several states
Low participation of voters for several locations, wey include Lagos, FCT, Oyo, Anambra, among odas.
For Lagos, Polling Unit 002, Holy Cross Ward D3, Popo Aguda, voter turnout no really encourage, even though Inec officials arrive and start di process early.
For Polling Unit 001, Ward 12, Popo Aguda, INEC officials arrive, but voter participation still remain low.
Electoral officials arrive early for di polling units for Lagos Island, but voter turnout dey generally low.
Some voters say dem receive text messages from Inec wey invite dem to participate for di exercise, while some others say dem no even know say di exercise dey happen.
However, di situation dey different for Kano state, as di turnout of voters dey high but most of dem bin tink say na di election proper, as dem dey request wia di political parties dem wan vote dey.
Also majority of pipo wey come out na women.
Some civil society organisations wey dey monitor di exercise don also express concern over wetin dem describe as inadequate mobilisation of voters ahead of di mock election.
Another tin wey BBC News Pidgin observe for di polling units dem visit na say, no political party representatives dey present.
Challenge wit results capture, upload and public viewing
Di accreditation exercise bin face technical challenge as electoral officers bin dey try to upload election result for Polling Unit 018, Area 10, Abuja Municipal Area Council (AMAC), for di Federal Capital Territory.
Di wahala happun afta election officials don finish sorting and counting of ballot papers, as dem dey try upload di result to INEC Result Viewing Portal (IReV).
Di Biometric Voter Accreditation System (BVAS) reportedly malfunction during di upload process, wey make officials no fit transmit di result for more dan 15 minutes.
Di technical problem don raise concern among election observers wey dey monitor di exercise, as some of dem express dissatisfaction over di malfunction and question whether similar wahala fit affect di conduct of di 2027 general election.
Some observers say technical challenges during result upload fit undermine pipo confidence for di electoral process, if di commission no address am properly bifor di next general election.
Elections observers wey follow di exercise also report say, for Polling Unit 018, Garki Ward 01, officials bin experience difficulties in capturing di image of Form EC8A wit BVAS.
For dis polling unit, e take more dan 30mins to upload di image of di Form EC8A afta several tries.
Dem note say di foto dem capture improve wen dem put di sheet on dark surface.
One of di mock political parties dem list on di paper Form EC8A also miss from di electronic EC8A. Dis mismatch bin lead to incorrect electronic vote total and e delay di upload.
For Polling Unit 020, Wuse Ward 04, Bannex Plaza Junction, observers report say di BVAS bin take at least 30 minutes to capture di results sheet.
Security presence, access restrictions and reported delays in deployment
Di presence of security agencies full ground for some polling units wey di Inec mock accreditation exercise bin hold across Nigeria.
For Lagos state, di state Commissioner of Police, Tijani Fatai bin do security check around Lagos, as di mock election exercise dey go on.
E tok sey no gbege don happen so far, but e no fit do correct tok tok for now sake of say e still dey check oda polling units.
For Kano state, security also tight for di polling units BBC News Pidgin monitor and no report of any wahala.
















