NDC Presidential Primary: Political parties for Nigeria round up primaries ahead of Inec deadline

Published
Read am in 6 mins

Di Nigeria Democratic Congress (NDC) dey hold dia presidential primary election on Friday wia dem dey expected to officially announce former Anambra State govnor Peter Obi as di party main flag bearer.

Dis dey come as di 30 May deadline wey di Independent National Electoral Commission (Inec) set for parties to submit di names of dia candidates for di 2027 general election, don almost reach.

Obi na di only candidate wey pick di form for di NDC to contest for presidency, but even though say na only im, di party go still do primary to officially adopt am.

Across di kontri, di NDC dey continue wit di primary elections for di oda aspirants wey dey run for different positions, from House of Representatives to Senatorial and govenorship seats.

Dis elections bin dey fixed for 27 and 28 May, but sake of say di Eid-El-Kabir holidays bin fall inside dose two days, di party say e bin cause logistic challenges for dem.

Kano former deputy, Fubara join govnorship race

For Kano State wia di former govnor Rabiu Kwankwaso na di leader of di NDC, tori be say di party go adopt di immediate past deputy govnor, Aminu Abdulsalam Gwarzo, as dia consensus govnorship candidate.

Gwarzo bin resign as deputy govnor afta e refuse to folo di govnor, Abba Kabir Yusuf, to decamp from di New Nigeria Peoples party (NNPP) to di ruling All Progressives Congress (APC).

As Kwankwaso later leave di NNPP - party wey im bin form by imsef - to di NDC, Gwarzo folo am for back, and by 2027 e go face im former oga, di govnor, for di govnorship election wey many sabi say e go be tough challenge.

For Rivers State, di NDC govnorship primaries dey even more interesting as Blessing Fubara Senior, di younger brother of di current govnor, Siminialayi Fubara, pick form to contest for di ticket.

Di lesser known Fubara say e wan complete di tenure of Rivers Southeast Senatorial District, afta govnor Fubara bin withdraw from di APC govnorship primary election.

"I don vow to do only one 4-year tenure to bring di expected prosperity and development for River State," Fubara tok, as e add say afta di four years im go support di next candidate from anoda senatorial district.

Meanwhile, for Delta State, former deputy senate president Ovie Omo-Agege don join di NDC afta losing di senatorial ticket of di ruling APC.

Omo-Agege describe di NDC as "party wey dey built on di principles of inclusion, accountability, grassroots participation, and true federalism".

"Afta careful consideration, I dey convinced say di NDC offer di clearest path to advance di interests of Delta Central, Delta State, and Nigeria," Omo-Agege tok for im statement.

APC, ADC, NDC, PDP presidential candidates

As di primary elections wrap up for di different political parties, tins don dey clear about which candidates go contest di 2027 general election, especially di ogbonge post wey be di presidential seat.

For di ruling APC, President Bola Ahmed Tinubu emerge di candidate with almost 11 million votes.

Many bin expect say Tinubu no go get challenger for di ticket, but di APC tok say anoda aspirant - Stanley Osifo - folo am drag di ticket, but e only win16,503 votes while Tinubu get 10,999,162 votes.

Di president, for im acceptance speech, promise to use di next four years to put Nigeria on di "irreversible path of economic expansion".

For di Africa Democratic Congress (ADC) wey be di main opposition join-bodi movement for Nigeria, former Vice President Atiku Abubakar win di presidential primary election.

Atiku get a total of 1,846,370 votes, to defeat im rivals, former Rivers State govnor Rotimi Amaechi (504,117) and businessman Mohammed Hayatudeen (177,120).

Di election almost scata di ADC as both Amaechi and Hayatudeen allege say plenty wuruwuru bin full for di process and say dem reject di results.

However, on Thursday, Atiku bin pay Amaechi visit for im house for Abuja and di two men snap foto as dem dey laugh, dey greet each oda warmly, wey be like say dem don settle.

For di Nigeria Democratic Congress (NDC), e don almost sure say na Peter Obi go come out as dia presidential candidate.

Obi bin don already promise say e go do only one tenure if e win, so dat di normal convention of rotating di presidency betwin di north and south go continue.

Na for di Peoples Democratic Party (PDP) wey big internal crisis still dey go on, despite say di Supreme Court bin do deliver judgement for di mata wey many say e suppose end di whole issue.

Di PDP still dey divided into two factions, and di two groups don nominate presidential candidate each.

On Tuesday, 26 May 2027, di PDP faction wey di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, dey support, nominate one former Senator, Sandy Onor, as dia consensus presidential candidate.

For di event for di PDP national secretariat for Abuja, chairman of dia screening committee, Samuel Ortom, tok say Onor na di outstanding candidate wey dem sure say e go take di party to victory.

Meanwhile, di order PDP faction, led by Tanimu Turaki, don clear former President Goodluck Jonathan as dia own candidate.

Di Turaki faction say dem waive di screening process for oga Jonathan bicos e don serve di kontri from deputy govnor to govnor to Vice President and den President, so to undergo screening again no make sense.

However, Jonathan imsef neva clearly tok say e dey interested for di presidential contest. Di last time wen some of im supporters visit am to persuade am to contest, e tell dem say e go consult widely bifor e go make im decision.

Nevertheless, di Turaki PDP tok say dem go hold special national convention on Saturday, 30 May, to formally ratify Jonathan as dia consensus candidate.

E neva clear wich of dis two PDP factions wey Inec recognise, but wetin dey clear be say one party no go fit get two presidential candidates for di same election period, na either one of dem go make am to di ballot, or di two no go make am.