Why Tanzania vice-president Emmanuel Nchimbi resign

    • Author, Alfred Lasteck
    • Reporting from, Dar es Salaam
  • Published
  • Read am in 3 mins

For inside one move wey neva happun bifor for Tanzania, Vice-President Emmanuel Nchimbi announce say im dey resign and go retire from public life for di end of next week.

Im resignation dey come less dan 10 months afta dem swear am in as di East African kontri vice president.

Di 54-year-old bin announce im resignation for inside one brief letter to President Samia Suluhu Hassan, e also share am on im Instagram account.

Sources for im office and di presidency confa di resignation.

Nchimbi, wey go be di first vice-president to step down since independence for 1964, explain say im dey quit in line wit one promise e make to di president say im go go, if she feel say she need anoda vice-president.

Di resignation dey come for di middle of media reports say Samia don fall out wit her deputy.

Dem swear-in Nchimbi for last November afta one successful campaign as Samia running mate for di presidential election.

Di outcome of di election wey dem say di winner get 98% share of di vote, no go down well wit di opposition parties and dem challenge am.

Di controversial election bin lead to violent protests and deaths of at least 500 pipo according to one official enquiry.

Opposition parties and human rights groups bin accuse security forces say dem release brutal crackdown on anti-govment protesters.

"I dey convinced, without doubt, say di president want changes, and I therefore don decide to fulfil my promise," Nchimbi write for im resignation letter wey refer to di pledge e make to Samia.

E thank di president plus di ruling Chama Cha Mapinduzi (CCM) party for di trust dem get for am, and to Tanzanians for their support during im time for public service.

E say im dey leave office in accordance wit di kontri constitution and go continue to be a "good citizen of Tanzania".

Nchimbi bin serve as as secretary-general of CCM. E also don hold several senior positions for govment, wey include both minister of information and home affairs, bifor e bicom Tanzania ambassador to Brazil and later Egypt.

In recent months, tori of a fallout bin dey between di two leaders.

Nchimbi bin don also make public comments calling for a new constitution and greater emphasis on di rule of law, issues wey dey central wetin Tanzania opposition dey demand for.

Who go replace Emmanuel Nchimbi?

Tanzania President Samia Suluhu don confam say she don receive Vice President Emmanuel Nchimbi resignation wey go ake effect on 4 September.

For one statement wey di president Chief Secretary, Moses Kusiluka issue on Tuesday evening, e say President Samia don accept vice-president resignation.

Kusiluka said constitutional procedures don already dey in place for di appointment of a new vice-president.

Under Tanzania Constitution, wen di office of vice-president bicom vacant, di president go nominate pesin, wey di National Assembly must approve within 14 days of di resignation, in accordance wit Article 50(4) of di constitution.

Di president therefore get until 18 September to complete di process.

Parliament must confam di appointment by a majority vote of di Members of Parliament, and upon confirmation, di new vice president go begin work afta dem swear am in.

Parliament go begin dia fourth meeting on Wednesday, 26 August.