You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How two airport workers die of malaria afta 'mosquito enta inside plane'
- Author, André Rhoden-Paul
- Published
- Read am in 3 mins
Two Frankfurt Airport workers don die of malaria afta one rare outbreak make six employees catch di serious infection wey mosquitoes dey spread.
German public health officials believe dey di mosquitoes land Germany busiest airport on top one plane, wey trigger di outbreak dem first detect for July.
One tok-tok pesin for airport operator Fraport tell BBC say na one employee bin die sake of di infection, but on Wednesday, public health officials later confam say two of di affected individuals don die.
Dem don set traps for di airport and wen dem catch di mosquitoes dem go check dem for lab to find out wia dem come from and di kain specie dem be.
"We don provide full informate to all employees and don encourage dem to go see dia doctor if dem get any symptoms".
Frankfurt Public Health Department say dem dey investigate di outbreak.
Di BBC hia say six male airport workers wey bin dey work for different jobs and different parts of di airport dey infected. Di offcials don dey analyse dia blood samples to find out weda na one mosquito bite all of dem or na six different mosquitoes.
Dem say laboratory tests to determine di source of di infections no go dey available for several weeks.
End of Di one wey oda users dey read well well
For July, tori bin comot say di outbreak don infect four workers.
Di Robert Koch Institute wey be German federal govment agency and research institute for disease control and public health, bin tok bifor say di four employees bi sick between 4 and 6 July and mosquiotoes use plane come.
Di institute tok say malaria for Germany dey almost always affect pipo wey travel far and catch di malaria for places wia di disease plenti well-well. Dem say for pesin to catch am for inside German airport dey rate.
Di institute right for inside dia epidemiological bulletin say, "di lack of travel history fit cause delayed diagnosis wey raise di risk say di sickness go dey severe".
Di last case of airport malaria for di kontri na for 2023 nad e happun for di same airport.
Malaria na disease wey mosquito dey spread wen dem bite pipo. Dem dey normally find am for tropical kontris, na wetin di World Health Organization (WHO).
Di infection wey dey preventable and curable dey come from parasite and no det spread from pesin to pesin. But symptoms fit go from mild to life-threatening.