South Africa anti-immigration leader shot dead, police begin investigation as five suspects impersonating Home Affairs chop arrest

Published
Read am in 4 mins

Authorities for South Africa dey investigate di killing of one of di leaders of anti-immigration movement March and March wey dem shoot.

Earlier dis month, dem shoot March and March Guateng leader Andile Mvuyelwa Somgxada for outside im home on 4 July, few days afta di June 30 protests.

According to di police, di movement leader die afta e sustain injuries for di shooting.

Mr Somgxada na di Gauteng province leader of March and March, di anti-immigration group wey dey organise nationwide protests in recent months, including di June 30 deadline protests.

For dia statement, South African police say dem don put security team togeda wey go investigate di killing of Somgxada.

"Dem shoot Mr Somgxada for di driveway of im home for Greenfield, Johannesburg, on 04 July and e die for hospital on 9 July due to im injuries.

"Di Acting National Commissioner of di South Africa Police, Lieutenant General Puleng Dimpane, in consultation wit di Gauteng Provincial Commissioner, Lieutenant General Tommy Mthombeni, don assemble multidisciplinary team of seasoned detectives and Crime Intelligence officers to lead di investigation into di murder of March and March Gauteng leader, Mr Andile Mvuyelwa Somgxada," dia statement tok.

South African police head condemn di attack wey lead to di death of di protest leader, but add say dem go make sure to trace and catch dose wey dey responsible for di murder.

"Di appointment of multidisciplinary team show di seriousness wey di South Africa Police dey use treat di mata."

Di police say dem dey committed to conduct thorough investigation to establish di circumstances wey surround di murder of di March and March leader and to ensure say dem dey accountable.

"Acting National Commissioner issue serious warning to individuals and groups wey continue to intimidate, harass and do violence against foreign nationals, say dat kain actions dey unlawful and dem no go tolerate am."

Meanwhile, according to di leader of di March and March movement, Jacinta Ngobese-Zuma, protest against undocumented migrants for South Africa go continue until di govment introduce tougher laws against illegal migration.

She say March and March go dey protest evri Thursday for di next six months to force di govment to "get rid of" undocumented migrants wey still dey for South Africa.

Sake of dat, South African police cut ears give dose wey still dey harass migrants say make dem stop am.

Five suspects chop arrest for impersonating Home Affairs

Di police don gbab five suspects wey dey parade demsefs as officials of di South Africa Home Affairs.

Dem say dis fake Home Affairs officials dey purse foreign nationals comot for South Africa wen dem no get di right to do so.

Di police say dem receive di "arrest of five suspects for Lephalale, Limpopo, wey dey allegedly disguise as officials from di Department of Home Affairs and unlawfully demand di removal of foreign nationals from Marapong Township".

According to di police, di fake officials harass one Nigerian wey dem force to close im shop but dem later find say di pesin get di required documents to live for South Africa.

"Di incident involve Nigerian national wey dem intimidate and force to close im business afta di group allegedly claim say foreign nationals no dey permitted to operate businesses for South Africa."

Wen di mata reach di Department of Home Affairs, dem verify say di Nigerian wey dey harassed get di documentation wey confam say e dey for di kontri legally wit all valid documentation to operate im business.

"Di law apply equally to evrione. No individual or group get di authority to conduct immigration inspections, verify legal status, or remove pipo from communities. Dose responsibilities rest wit law enforcement agencies and relevant govment departments," South Africa police tok.