Trump administration establish task force to end birth tourism for US, revoke ova 600 visas

US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Alex Wong/Getty Images

Published
Read am in 4 mins

US President Donald Trump administration don establish task force to end birth tourism for di kontri.

Di US Department of State say dem dey use all available tools defend di integrity of US citizenship, ensure say pipo wey get non-immigrant visas use dem only for dia lawful and intended purposes, and prevent dia exploitation through birth tourism.

Dem dey call di taskforce Birth Tourism Prevention Task Force.

"As President Trump don make am clear, citizenship no be commodity to dey acquired through di calculated exploitation of U.S. immigration laws.

"Di Department of State dey working closely wit di Department of Homeland Security (DHS) to combat birth tourism and protect di integrity of di U.S. immigration system," di statement tok.

Wetin di taskforce go do?

Di Department of State say di di Birth Tourism Prevention Task Force go dey review di activities of visa holders worldwide to identify instances of birth tourism, take action to revoke visas of dose wey engage in or facilitate am, and dismantle di networks "wey dey profit from dis abuse".

Dem say di task force go address di abuse by analysing and connecting information held across di Department and oda federal agencies, including di Department of Homeland Security (DHS).

According to di statement wey dem release, di Department of State dey address birth tourism on global scale, and dey examine travel histories of individuals from all around di world "in order to end dis exploitation and abuse".

"Di Birth Tourism taskforce don take action by revoking more dan 600 visas from foreign nationals across di globe to safeguard our nation from dis abuse.

"Di Department generally revoke visas wen indications dey of potential ineligibility dey," di statement tok.

Di statement also say di Secretary get "broad discretionary authority to revoke visas – and di Trump Administration dey committed to exercise dat authority to protect di American people and di integrity of our immigration system".

Di US Department of State say birth tourism don become industry wey pipo dey use make money.

"Dis facilitators sometimes dey market demsefs as doulas, midwives, or wellness advocates while dem dey openly advertise "birth for di U.S." services, visa coaching, and hospital arrangements.

"Some dey forge medical documents or coach clients to hide dia true travel purpose and avoid paying hospital bills, wit online marketing wey dey promise clients "automatic citizenship" and "a future witout borders"."

Dem say birth tourism for US involve citizens from kontris across di world.

"Di Department dey take action to dismantle dis networks and hold all participants accountable."

US issue strong warning

Di Department of State say di work of di Bureau of Consular Affairs Task Force and consular officers for US embassies and consulates around di world na to expose widespread patterns of magomago.

Dem say foreigners wey wilfully misrepresent di purpose of dia travel or entry into di United States fit dey permanently ineligible for US visa or entry to di United States.

"Di Department don uncova patterns wey illustrate di lengths some applicants go go to play wayo wit our laws in order to secure U.S. citizenship for dia children – and potentially for demsefs for future.

"One couple bin use conference and vacation trip to go shopping as cover stories to give birth to two children for United States, lying about dia travel purpose in two separate visa applications. On di second occasion, di couple hide say dem born pikin. We don revoke di visa," Di Department of State tok.

Dem say for anoda case, one foreign govment official bin request visa to travel on behalf of her govment for just one week, but instead stay three months and born pikin for United States bifor she comot. Di Department pf State say dem revoke di visa.

"Anoda traveller apply for visa to go on vacation for Orlando and instead travel go Los Angeles and give birth five days afta arrival. Di Department revoke di visa."

Di US Department of State say citizenship no be commodity to dey acquired through calculated exploitation and evasion of di immigration laws.

"Foreign nationals wey abuse di visa system, and dose wey dey help dem do so, fit lose dia visa, dia access, and dia future for di United States. Dis na only di beginning," di statement add.