PSG win Champions league back to back afta penalty shootout against Arsenal

Published
Read am in 11 mins

Paris St-Germain win di Champions League for second year in a row.

Heartbreak for Arsenal as dem miss two penalties for di shootout -afta Eberechi Eze fire wide and Gabriel shot ova.

David Raya save from Nuno Mendes, but e no dey enough.

PSG become di second team dis century to win di Champions League for back-to-back seasons (2025 and 2026), following Real Madrid three in a row between 2016 and 2018.

Dem be di first French team eva to win di European Cup / Champions League for consecutive editions.

How Arsenal vs PSG take waka

Penalty Shootout

PSG: 1 - 1 - 0 - 1 - 1

Arsenal: 1 - 0 - 1 - 1 - 0 -

We dey head now to di penalty shoot out.

PSG 1 - 1 Arsenal

FULL-TIME

Corner Kick for Arsenal.

GREAT SHOT for Arsenal as Gyokeres find di chance to pull a shot straight to goalpost but e dey deflected.

Timber wit di ball, e touch di ball well, e shoot, but di ball go back of di sidenet.

PSG dey lead wit ova 70 per cent ball possesion.

119mins - Any goal at dis point na straight win for di team wey go score. Mendes chop Yellow Card.

117mins- Barcola controlling PSG midfield, feeding Mendes wit good pass, Hakimi by di side also pressing on. PSG just dey control di ball round.

115mins - Eze carry di ball ooo, e run wit am near di box 18, but im pass go straight to PSG keeper hand.

Zubimendi wit di ball, e find Declan Rice for di side.

113mins - Long pull by PSG striker ova David Raya, but e catch am from up. Saliba move wit di ball.

111mins - Penalties dey 10 minutes away. Or will dia be a late, late winner?

108mins - Decelan Rice wit di chance for a free kick. E play a wide ontop di players, as PSG goalkeeper push am out.

Second half of di extra time don begin wit so much pressure for di pitch.

EXTRA TIME

PSG 1 - 1 Arsenal

First Half Of Extra-Time Ova

105+2mins - Eze wit di ball, trying to drive into PSG box, but dem no give am chance.

105mins - PSG pressing in from di far right

YELLOW CARD - Arteta and Declan Rice chop yellow. Gabriel dey call for substitute.

102mins- Noni Madueke take on Nuno Mendes and di di two fo dem fall to di ground inside di penalty area. Referee no give any penalty

100mins - Arsenal get only one shot on target all match dat Kai Havertz sixth-minute goal.

98mins - SUB' Warren Zaire-Emery enta for PSG, to replace Fabian Ruiz.

95mins - Wat a great opportunity for Arsenal from Timber but e no believe say e no enta

Anoda corner for Arsenal. Madueke take am again but dis time e go ova di bar.

91mins - Noni Madueke wit good run wit di ball, e cross am ova, but e deflect go corner.

EXTRA-TIME

90+6mins - Bradley Barcola shoot ova di bar. Dat na di same position as from Kai Havertz scored, but di effort go off target.

SUB' PSG goalscorer Dembele out,

YELLOW CARD for Neves

90+4mins - Intense pressure on di pitch as PSG dey control di ball.

90+2mins - Game back on. Hakimi wit di ball by di right side of Arsenal as PSG press into di box of Arsenal

David Raya dey call for treatment. E dey stretch afta e dive for Vitinha shot.

6 MINUTES ADDED TIME

90mins- PSG Vitinha wit a chance for all di glory, from 20 yards out, e hit am first time and di ball is just ova di top, clipping di net as it go ova.

89mins- Martinelli get di ball, na counter attack, e run wit di ball, Madueke by di middle, Gyokeres for di left side, but e pass di ball go di middle wia PSG goalkeeper Matvei Safonov catch am.

85mins - Mikel Arteta dey hope Noni Madueke and Martinelli go be im good finishers to give correct goal.

What A Chance for PSG, but Raya deny dem anoda chance for goal as e rush out to catch di ball.

83mins - Good pass to Gyokeres, but PSG defender clear am comot and di ball go throwin in favour of Arsenal.

SUB' Saka out, Madueke in for Arsenal, Kvaratskhelia out and Barcola in for PSG

80mins- Myles Lewis-Skelly dey involved in a race wit Desire Doue down di PSG left. E stay wit Doue and win free-kick. Excellent tracking back.

78mins - Khvicha Kvaratskhelia get did ball inside im own half and away e carry am go,, too quick and too skillful to get tackled.

Luckily for Arsenal, Myles Lewis-Skelly manages to get im foot to di shot, wit di ball bouncing off di left-hand upright.

70mins - PSG dey so close to taking di lead but Arsenal defenders dey block am.

BREAK- referee blow make di players get some break.

68mins- Big pressure for di stadium as Arsenal dey try keep dia defence tight.

Martinelli out, Gyokeres enta, Mosquera out and Timber is in.

PSG don level di goal against Arsenal afta Dembele score from di penalty spot.

PSG 1-1 Arsenal

65mins- GOOOOOOAAALL

61mins - VAR confam di penalty.

Penalty for PSG afta referee blow afta Cristhian Mosquera fall Khvicha Kvaratskhelia inside di box.

Corner Kick! For PSG

60mins - PSG pressing into di Arsenal box.

58mins - Good tackle by Bukayo Saka, as e stand gidigba against im opponent.

Good handling from David Raya as Achraf Hakimi take di PSG free-kick from range and di ball bounces just in front of di goalkeeper and Raya do well to hang on.

55mins- Hakimi take di free kick, good position, but straight to di hand of di goalkeeper

FREE KICK for PSG

YELLOW CARD - Bukayo Saka chop card afta tackle.

54mins - Referee blow foul afta

52mins - We neva see plenti movements from Ballon d'Or holder Ousmane Dembele and e dey on di PSG right wing, but Piero Hincapie dey hold am well.

Good clearing from Arsenal and PSG players.

50mins - PSG Nuno Mendes almost get a shooting chance, but William Saliba cleanly take di ball wit fine piece of defending.

48mins - Di ball is back in play

YELLOW CARD

Arsenal right-back Cristhian Mosquera chop yellow for delaying di restart and taking too long to take di throw-in.

46mins - Arsenal fans dey pray to win ooo. As we return for dis second half wit Arsenal leading di game

SECOND HALF

HALF-TIME

PSG 0-1 Arsenal

Rare chance for Arsenal since taking di lead, as dem pressure PSG more for dia goal post.

CORNER for Arsenal

45+4mins - Kai Havertz, already wit one goal to im name, get shooting chance, but im effort deflects off of Marquinhos and dat wipe out any threat.

45+2mins- Anoda great chance for Arsenal, Saka wit di ball. Havertz wit di run into di box 18. oh no, PSG goalkeeper catch am.

6 MINUTES ADDED TIME

40mins- Arsenal win a free-kick from deep and Declan Rice send am into di middle. Gabriel and Kai Havertz both go for am, with Gabriel heading ova, but di whistle go up as Havertz commit foul.

38mins - Nuno Mendes float in a dangerous ball into di middle for PSG, but Declan Rice do well and dey well placed to clear di danger.

35mins- William Saliba get ahead im man to make anoda vital interception from anoda cross. e save di cross.

33mins- Di gameplan for Arsenal dey work perfectly. Dem dey control di ball wit dia tempo.

30mins- Myles Lewis-Skelly neva play for di midfield for Arsenal first team bifor dis month e start. Now e dey storm through di middle of di pitch driving at di heart of di PSG side for di Champions League final.

25mins- As soon as Khvicha Kvaratskhelia get di ball, di first tin Mikel Arteta do na to wave to Bukayo Saka to make sure e double up to help Cristhian Mosquera.

20mins - Piero Hincapie start well for left-back for Arsenal and get a vital foot in to stop Achraf Hakimi making progress down di PSG right.

18mins- Arsenal dey so discplined without di ball and all 10 outfield players dey within 30 yards of dia own goal as PSG try to drive forward and craft a way through.

15mins- PSG Achraf Hakimi get to di byline, but Piero Hincapie track am down to concede a corner, and dat come to nothing.

12mins- SO much pressure for dis game as di two sides dey run back and front to keep dia box 18 safe.

10mins- Good run by Saliba for di middle.

8mins - Kai Havertz na di only third player to score for two different teams in a Champions League final (Chelsea, Arsenal), afta Cristiano Ronaldo (Manchester United, Real Madrid) and Mario Mandzukic (Juventus, Bayern Munich).

7mins - Wat a finish! Arsenal get di di lead for di Champions League final. Kai Havertz just like e do for Chelsea

Kai Havertz put Arsenal for early lead. Good assist from Trossard.

PSG 0-1 Arsenal

6mins - Gooooaaaaal!!!!!

PSG goalkeeper no come out and e no keep di angle narrow. Kai Havertz see window high and into dat near post.

E shoot am wit power into di roof of di net.

4mins -PSG have a lot of di ball, but most of dat dey inside dia own half. Den a bit of slow from PSG Fabian Ruiz.

Oh! Almost a foul but ref no book am as e clear di ball throway.

2mins- PSG dey chase di ball as dem dey follow evri ball by Arsenal.

0mins- Kick Off! Arsenal start di Champions League final, and do so by flicking up the ball and launching it high into the sky.

PSG 0-0 Arsenal

Wetin go determine Champions league winner between Arsenal and PSG

Mikel Arteta Arsenal dey hope to follow up dia Premier League triumph wit Champions League trophy against Paris St-Germain on Saturday but which tactics go make am happun.

PSG na di defending champions afta dem make history to win dia first ever Uefa Champions League title for 2025.

PSG flog Inter Milan wotowoto to lift di trophy as di match end 5-0 wit Acraf Hakimi scoring di opening goal for di 12th minute.

But now, PSG dey play against strong Arsenal team wey win di Premier League trophy and also a stable team so far for di Champions league race.

Arsenal men don play well for Europe wit high possession wit di most clean sheets (9) for di competition so far.

PSG get only five clean sheets but dem di tournament top scorers as dem get 44 goals compared to Arsenal 29 goals.

Di game na hot one between di tournament best attack against di best defence.

Arteta go hope to play for PSG half as dem do for large parts of di two legs for last season semi-final.

Arsenal dey hope to win dia first Champions League while PSG dey look to retain di title, afta dem waya Inter Milan 5-0 for last year final.

Which tactics go determine winner between PSG and Arsenal

  • Di value of different type of number nine

One tactics wey work for both teams especially Arsenal during dia second-leg tie between di two sides last season na di use of midfielder Mikel Merino as number nine.

PSG get di ability to press intensely and sometimes dem like man-to-man fashion, and dis go challenge Arsenal wey dey like to build up dia game from di back.

One key principle of positional play na to find di free man. But wen opponents apply man-to-man pressure, to find free man dey hard.

Last match between di two sides, Merino drop deep into di central midfield as PSG centre-back Willian Pacho no gree follow am. Dat allow PSG to keep one extra player for dia defensive line.

Arsenal come get extra man for di midfield but striker no dey.

PSG three-man midfield dey always dey alert to Arsenal midfielders wey dey look to launch di ball give Merino but dat movement go need anoda Arsenal midfielder wey dey free to help di Gunners get up di pitch.

Although Swedish striker Viktor Gyokeres dey in strong form, wit Merino wey also dey fit again afta long absence.

Wit Kai Havertz, dis na players wey naturally fit do dis tactic.

  • Di bravery to play for small spaces

Last season, Arsenal struggled to score against PSG, wit di help of goalkeeper Gianluigi Donnarumma. But e no dey di team again.

PSG neva conceded many goals dis season but Chelsea, RC Lens and Bayern Munich don attack well against dem.

By positioning dia players close to each oda, dose teams draw PSG and dia man markers up di pitch into crowded area. Dis go come leave di oda parts of di pitch wit fewer players wey any team fit take advatange of.

Arsenal dey sometimes shy away from playing centrally, and like to focus more on safer attacking play and crosses, as losing di ball centrally go make you fall more to counter attack.

Arsenal fit rely on di likes of Leandro Trossard, Havertz, Bukayo Saka, Martin Zubimendi and Eberechi Eze wey dey capable to play close to each oda under pressure and dem supply ball to players wey fit finish moves centrally.

  • Stopping PSG moving attack

Khvicha Kvaratskhelia na explosive right-footed left winger and na one of football most dangerous players.

Arsenal go need to keep am quiet.

PSG under Luis Enrique dey move round but dem also dey follow certain rules.

One of dis rules be say dem get certain areas of di pitch wey dem like to dey keep occupied throughout di game including di two centre-back positions and di centre-forward position.

But who move into dis positions dey less important. So, Arsenal go gatz make sure say dem fit stop dia moving attack.

  • Set plays fit decide di final

E go dey bad to write about about Arsenal beating direct opponent without mentioning dia most effective tool dis season - set pieces and corner kicks.

PSG don only concede 29 goals for di league dis season but six of na from non-penalty set-pieces. Di size of dia squad make dis obvious area of weakness.

Be like say PSG no like to deal wit crosses wey dey float ova dia heads as dem dey track back.

Di header dey move back for di oda direction wey dey go against di direction wey dem dey move. Dis dey give di attacking side advantage as dem sabi wia di ball dey go.

Arsenal even dey better for dat, so if dey fit get up di pitch in di first place to force corner kicks or winning free-kicks, e go produce good looking goal.

While e get little wey players fit do for potential moments of brilliance, e get at least signs of hope say Arsenal fit hurt di defending champions- and table fit turn di oda way too.