Guinea-Bissau sama Nigeria 3-0 for Afcon 2027 qualifiers

Wia dis foto come from, Ulrik Pedersen/NurPhoto via Getty Images
Guinea-Bissau carry Nigeria eyes see pepper as dem do di Super Eagles wetin no good.
Di Djurtus knack Super Eagles 3-0 for di 2027 Africa Cup of Nations qualifier.
Nigeria Super Eagles no see chance to play ball as di Djurtus of Guinea-Bissau attack dem from start to finish.
Guinea Bissau score dia first goal through Franculino for di 15th minute, Balde score for di 66th minute while Djalo score di last goal few seconds to end of di match 90+5.
Dis na Nigeria second qualifiers match afta dem beat Madagascar 2-1 for Uyo for Friday, 25 September.
Guinea-Bissau also win dia first match against Tanzania by 2-1.
Na only di winner of di group go qualify for di 2027 Africa Cup of Nations wey Kenya, Uganda, and Tanzania dey host togeda.
Second Half
Full Time Guinea Bissau 3-0 Nigeria
90+8 Referee blow whistle to end di match.
90+ 5' GOALLLLLLLLL ! for Guine Bissau, Alvaro Djalo score late goal to finish Nigeria kpatakpata
90+3' Nigeria player Bright -Osayi carry ball dey run go Guinea Bissau defence but no player to support am as dem collect di ball from im leg.
90' Referee add 5 minutes
88' YELLOW CARD for Semendo of Guinea Bissau, e collec t card afta e tackle and block and push Alex Iwobi.
86' CHANCE ! for Nigeria, Bruno pass di ball to George Ilenikena`wey fire shot but Guinea bissau goalkeeper block am wit im chest.
85' Corner kick for Nigeria George Ilenikhena play am but Guinea Bissau defence clear di ball.
82' Guinea Bissau still dey press Nigeria seriously as dem attack against and Nwabali save di ball.
79' Match don resume afya di water break.
77' Dem don go for anoda Water break
77' Moses Simon play Nigeria freekick but Guinea Bissau defence wall block am.
74' Nigeria dey play short short passes to break di Guinea Bissau defence but e no still work.
71' Guinea Bissau dey do Nigeria wetin no good o, Nigeria neva fit score and as dem dey lose 2-0.
69' Nigeria Coach Eric Chelle don make some changes.
Guinea Bissau 2-0 Nigeria
66' GOALLLLLLL for Guinea Bissau as captain Balde double di lead
64' Nigeria dey try evritin to score but e neva work, e be like say today no be Nigeria day o.
60' Guinea BIssau wanscore but di playe fire di ball over di bar!
60' Chance for N igeria but dem head di ball give Gunea Bissau goalkeeper.
59' Guinea Bissau play di corner kick but Nwabali catch di ball.
58' SAVE! Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali save shot from Guinea Bissau player wey fire shot, Nwabali punch di ball go corner.
54' CHANCE! Moses Simon of Nigeria get chance to score buut e fire to ball go disfe hands of di Guinea Bissau goalkeeper.
52'Guinea Bissau dribble two Nigeria players as dem clear road for am to fire shot , but di shot too weak as e land for Nigeria goalkeeper Nwabali hand.
49' Di changes wey Nigeria Coach Eric Chelle make for dis second half don begin show as Nigeria don dey attack Guinea Bissau more.
47' Nigeria don begin attack Guinea Bissau for. dis second half b ut e no last as Guinea Bissau colect ball from dem again.
46' Second half don start
First Half
Guinea Bissau 1-0 Nigeria
45+4' First half don end
45+3' Nigeria bin play di ball go Guinea Bissau goal post but notin come out.
45' Referee don add 4 minutes
44' MISS! Guinea Bissau miss clear chance to double di lead as di player play di ball just small tin e or enta net.
42' guinea Bissau player bin fall for ground afta e try to score Nigeria but Stanley Nwabali Nigeri goalkeeper save di ball wit im two legs.
39' One-one counter attack wit as Guinea Bissau player carry di b all wan score but Nigeria defender Calvin Bassey colect di ball from di player leg afta e dribble am .
37' Guineas Bissau launch anoda attack for Nigeria goal area but di player fire diball over di bar!
36' Nigeria bin get chance to shoot but di ball land for Guine Bissau goalkeeper hand.
35' Guinea Bissau players just dey use Nigeria players dey run for field na dem dey hold ball since.
32' Match don resue afta di water break and e start wit attack fro Guinea Bissau to Nigeria goal area.
30' Di players don go on water break, dem dey sidelines dey drink water.
29' So far di two kontris dey drag ball possession wit almost 50-50 percent.
27' Nigeria don hold ball as dem dey try slow down di game but Guinea Bissau don collect di b all again dey run go Nigeria area.
25' Guinea Bissau no wan allow Nigeria Super Eagles setlle down as dem dey press dia neck.
23' Nigeria don collect ball dem play only two pass bifor Guinea Bissau collect di ball back from dia leg dey run go Nigeri goal area but referee blow whistle for foul.
21' Guinea Bissau player do counter attack, Nigeria player Frank Onyeka clear di threat as e trap di ball do back pass give goalkeeper Stanley Nwabali.
19' Guinea Bissau dey press Nigeria Super Eagles neck as dem justv dey attack back to back.
17' Guinea Bissau get chace for Nigeria goal area again but goalkeepr Staley Nwabali save di ball.
Guinea Bissau 1-0 Nigeria
15' GOALLLLLLLL for Guinea Bissau Franculino put di homeside for front.
14' Anoda chance for Nigeria but Ademola Lookman miss di chance.
12' Ademola Lookman rungo Guinea Bissau attack but di attempt no work.
8' Guinea Bissau player run go Nigeria goal area e bin wan fire shot but Nigeria defender Clavin Bassey clear di ball comot.
6' Trown-in for Guinea Bissau e go out of play and Nigeria get trow-in too but di ball land from Guinea bissau player leg afta e pass some Nigerian players.
4' Nigeria nad Guinea Bissau dey. drag ball for di midfield so far dem just dey try do one-two touches.
2' Guinea Bissau start di match hot hot as dem begin attack di Nigeria defence but defender Calvin Bassey of Nigeria clear di threat.
1' Referee don blow whistle, match don start
Line - up
Guinea Bissau starting 11:Fernando Embadje,, Jeferson Encada, Opa Sangante, Victor Rofino, Andramane Cassama, Dalcio Gomes, Ronaldo Viera, Renato Nhaga, Mama Balde, Beto, Franculino
Nigeria starting 11: Stanley Nwabali, Bright-Osayi, Onyemaechi, Wilfred Ndidi, Semiu Ajayi, Ademola Lookman, Frank Onyeka, Taiwo Awoniyi, Alex Iwobi, Calvin Bassey, Akor Adams



















