Police arrest popular Zimbabwe pastor Uebert Angel on top accuse of indecent assault

Zimbabwean self-styled prophet Uebert Angel point im index finger as e dey tok for one public event for 2014. E wear one light grey suit and one red and maroon tie wit one red carnation for di side of im suit.
Wetin we call dis foto, Uebert Angel still dey police custody afta police arrest am ova di weekend
Published
Read am in 2 mins

Police for Zimbabwe don arrest one popular preacher on top allegations of sexual offences.

Authorities arrest Uebert Angel, wey dey lead one international charismatic church wey get branches around di world, during one church service for Harare on Sunday, 22 November.

Fotos and videos of di dramatic arrest don spread online.

For one video wey don go viral, e show as one convoy of vehicles dey escort di self-styled prophet as e siddon for di back of one police van and armed police officers surround dem.

Dem appoint di controversial founder of Spirit Embassy as Zimbabwe special presidential envoy and ambassador-at-large to Europe and di Americas for 2021.

E don comment on di allegations.

For 2023, e bin make headlines wen one undercover report by Al Jazeera claim say e bin offer to use im diplomatic status to launder large amounts of money through one gold-smuggling scheme for di kontri.

According to di Qatar-based network, 48-year-old Angel tell tori pipo wey dey undercover say na President Emmerson Mnangagwa approve di scheme.

Di 48-year-old British-Zimbabwean preacher dey born and grow up for Masvingo, Zimbabwe, bifor e later waka go Manchester, England, wia e start di Spirit Embassy Ministry.

Dem bin dey tok say e be correct oga wey sabi preach, and na one of di main pipo for di new prophetic movement.

Dem tok say dem cari Angel go jail afta like 10 men wey get AK47 enter church wen service dey go on, dem tie preacher hand. Bifor e waka enter real estate, Angel don start Millionaire Limited for 2005.

For March 2023, dem make Uebert Angel ambassador for inter-faith tok and humanitarian mata for di Pan-African parliament of di African Union but dem tok say dem comot am from di position later dat year bicos gbege full ground about how dem take put am for di job.

Ova di years, Angel don also face gbege for money mata wey dem tok say pass $300,000.

Dem tok say na 2015 e comot for UK to dodge arrest warrant, but for 2016, Harare magistrate Vakayi Chikwekwe cancel am.

Angel sef tok say Zimbabwe financial intelligence unit, FIU clear am afta dem hear tori wey Al Jazeera do for dia Gold Mafia investigation for March 2023. Di investigation tok say Angel dey involved for international money laundering mata and how e dey misuse diplomatic privileges.

Uebert Angel marry Beverly Madzudzo, wey be businesswoman and co-founder of Spirit Embassy. Di couple get three pikin dem.

People still dey yarn about how dem take arrest di preacher, some tok say e be like say na politics dem dey play for am.