Twenty kidnapped prospective corps members regain freedom - Police confam

Published
Read am in 3 mins

Twenty prospective members of di National Youth Service Corps (NYSC) wey suspected gunmen kidnap as dem dey travel from Ibadan, southwest Nigeria go dia orientation camps for di South-East don regain freedom, di Nigeria Police Force tok.

Tok-tok pesin for di Force Ani Iniedu confam dia release for inside one statement on Wednesday, 7 October, six days afta dia kidnap.

"Dem rescue di victims on 7th October 2026 for Amakohia Ubi Village, Imo State, following sustained search-and-rescue operations," di statement tok.

Aniedu say di operation na in collaboration wit oda security agencies, as e add say efforts dey go on to arrest dos wey dey responsible for di abduction.

Earlier, di palace of di Olubadan of Ibadanland, Im Royal Highness, Rashidi Ladojabin tok say di Imo State govnor, Hope Uzodinma confam dia release during one telephone conversation wit di monarch.

Details of di release and weda if dem pay any ransom, plus di exact security operation wey secure dia freedom neva dey available.

According to Imo State police, di incident hapun at about 0630hrs on 1st October, along di Owerri-Onitsha Road, by Umunoha road.

Following di abduction, security agencies bin launch coordinated search-and-rescue operation to locate di victims and dia abductors.

Police for Imo State later tok say dia operatives don locate di kidnappers' camp through drone surveillance but dem no fit advance go di location becos intelligence show say dem surround di place wit improvised explosive devices (IEDs).

Di state commissioner of police Audu Bosso tok say na drones dem use locate di camp, but security forces neva fit move in becos believe dey say, di jaguda pipo plant explosives around di area.

Di police later deploy additional operational assets, wey include bulldozers and armoured personnel carriers, as efforts intensified to reach di victims.

Di abduction bin also make families of di victims worry afta tori come out say di kidnappers dey demand ₦50 million for each victim.

Police bin earlier confam say dem don secure di release of 10 victims afta di attack, and efforts dey on to locate di remaining abductees. Dem also tok say dem dey try verify di number of pipo wey dey captivity.

Di Defence Headquarters later tok say na 20 pipo di jaguda pipo arrest.

E neva dey clear di group wey abduct di corps members plus di oda passengers for di south east region, but e dey come few weeks afta di Abia State Police Command say dem don recova twenty-eight (28) human skulls and human bones from one forest for di state.

Meanwhile, Imo state govnor Hope Uzodimma, don hail security agencies for dia quick intervention in securing di release of di 20 corps members.

For inside one statement e personally sign, Uzodinma say im dey happy wit di security agencies for dia collaboration and patriotism in ensuring say di corpers dey rescued unharmed.