Ghana win 2026 Amputee football World Cup for Mexico

Wia dis foto come from, NATIONAL PARALYMPIC COMMITTEE OF GHANA
Di Black Challenge of Ghana don win di 2026 Amputee football World Cup wey happun for Mexico.
Dem beat Morocco 1-0 for di final afta dia impressive tournament.
Ghana captain Richard Opentil bin score di only goal for di 32nd minute of di game.
Di game be tough as Morocco also get chance to score but di Black Challenge hold on to claim dia first World Cup trophy.
Di Black Challenge bin show determination and defensive discipline to protect dia advantage and hold Morocco to di final whistle.
Ghana be di second African kontri to win di trophy afta Angola bin win am for 2018.
Dis final na rematch of di 2024 African Amputee Cup of Nations and di 2023 African Para Games final.
For those two finals, Ghana bin sama Morocco 2-1, na dis World Cup now be di third time dem meet for final in four years.
End of Di one wey oda users dey read well well
Captain of di team Richard Opentil afta di victory dedicate di trophy to di kontri and Ghanaians.
"Dis be dream come true. Dis victory be for di whole Ghana, di president. Dis be trophy to celebrate Christmas," di captain tok afta di game.
Richard Opentil add say "we present dis trophy to all Ghanaians; dis be our service to our kontri."
Ghana striker Mubarik Mohammed win di golden boot wit seven goals.
Mubarik Mohammed tok say " I dey proud of myself, we tank God say we make di kontri proud. We tank our fans for di support; dem stay up late to watch us."
Road to di final

Wia dis foto come from, NATIONAL PARALYMPIC COMMITTEE OF GHANA
24 teams bin participate for di World Cup for Mexico wey dem play about 80 games.
Dis be di 20th edition of di tournament afta dem first host am 40 years ago.
Ghana begin di tournament for Group D wit 2-0 defeat against former champions Angola.
Dem later draw 1-1 wit Colombia bifor dem scata Iraq 6-0 to qualify for di knockout stage.
Di Black Challenge sama USA 3-1 for di R16 wey dem later beat Egypt 2-0 for quarterfinal.
Di semifinal bin dey tough – dem face defending champions Türkiye wey dem win 4-3 for penalties afta 1-1 draw for regulation time to set up all-African final wit Morocco.
Afta di tight final, Ghana bin win 1-0 to secure dia first eva World Cup title.
Di kontris Sports Ministry don congratulate dem for dia historic achievement.
"On behalf of di govment of Ghana we congratulate di players, technical team and officials for dia win."
Di minister add say "you don conquer Africa for 2021 and 2024 now you don conquer di world."
"Dis be victory for every young Ghanaian wey dream to wear di national team colours – especially pipo wit disabilities. Your victory dey bring dat dream closer," di sports minister Kofi Adams add for im statement.

Wia dis foto come from, NATIONAL PARALYMPIC COMMITTEE OF GHANA
Di team bin struggle with resources to prepare for dis kind of tournaments.
Some companies bin step in to provide sponsorship and support wey help dem to get di victory.
Di minister also thank dis partners wey support di team.
"We tank Gold Fields Ghana limited; di CEO of EEzzy Group Foundation, di National Paralympic Committee of Ghana and oda corporate partners wey stand behind di team."
Kofi Adams finally tok say "dis trophy dey belong to kontri wey dey grateful. Di honor of winning di trophy be your own."
Di Black Challenge wey dem form for 2007 don shine for di last three years wey dem conquer every wia.
For 2023 dem become first ever African Para Games champions bifor dem win back-to-back Amputee Africa Cup of nations titles.
For 2026, dem reach dia first-ever Amputee Football World Cup final, wey dem now win am as World Champions.
























