You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Mexicans na di highest foreigners we don arrest for illegal meth labs' - NDLEA bust wia dem dey cook drugs
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) wey be di drug police for Nigeria don tok say dem no go allow Mexicans redirect dia production from oda places to Africa, especially Nigeria.
Dis dey come afta officers of di anti-drug agency destroy anoda industrial-scale methamphetamine laboratory.
Dem also arrest one Mexican drug kingpin wey bin dey try to run comot from di kontri through di Lagos airport.
NDLEA tok-tok pesin, Femi Babafemi tell BBC News Pidgin say dem no dey just waka go anywia dey find dis illegal laboratories but dem get beta information.
"Our operations dey 100 percent intelligence-led." Im add say dis fresh operation don expose how desperate transnational cartels dey find different ways to enta Nigeria forests and rural communities.
Oga Femi tok say for anytin wey concern illegal methamphetamine production for laboratories wey dey inside forests na Mexicans get di highest number.
"So far na Mexicans get di highest number, dis year (2026) alone wey don arrest five Mexicans, three for Ogun State, one for Oyo State and anoda one for Lagos airport."
For statement wey dem bring out on Tuesday 15, September 2026, im give more details about di Mexicans wey di agency don arrest.
"Operatives early dis year bin don arrest three Mexican nationals and seven Nigerian collaborators for one forest hideout for Ogun State on Saturday, 16th May 2026, and, on 17th June, dem arrest anoda Mexican national wit four Nigerian collaborators for one methamphetamine laboratory wey dey inside di forest part of Tapa village, Ibarapa North Local Govment Area of Oyo State, wia field tests confam large quantities of methamphetamine and precursor chemicals."
Im add say no be only for southwest dis illegal laboratories dey, dem dey chook eye for oda parts of di kontri and find and arrest dem, di same way dem bin arrest one for Ebonyi State, southeastern Nigeria.
According to NDLEA, investigations by dia Special Operations Unit (SOU) into di Oyo State arrest lead operatives to establish say di 56-year-old Mexican methamphetamine expert wey dem arrest for di forest lab bin dey recruited into Nigeria by one Mexican kingpin.
"However, our findings give us different tori. Investigators recova images of Arturo dressed in a blue laboratory coat, standing amid equipment consistent wit methamphetamine production. Analysis of di location metadata lead our operatives to one property wey dey under construction for Isiata Ugoni Okposi, Ebonyi State.
According to NDLEA, some of di tins wey dem recova include:
One dehydrator wey contain white cloth sieve wit loose methamphetamine.
Three additional empty dehydrators; 442.8 kg of Acetone, 37.1 kg of Toluene
20 kg mixture of Acetone/Bromobenzene, 1.7 kg of Ethanol, 5.1 kg of Chloride Salt, 31.5 kg of Hydrochloric acid, 200 kg of P2B, and 1 kg of Tartaric acid; Condensing units, condenser head, condenser, and fabricated reaction pot.
Dem also recova access pump, weighing scales, mixers, drums, gas burners, gloves, and blue laboratory coat wey match di one wey dem bin recova for anoda property.
"Dis recovery, wey we take togeda wit di CCTV evidence, oda forensic evidence and eyewitness accounts, don significantly strengthen di case against all di pipo wey dey connected to dis network."