South Africa confam deaths of two Nigerian citizens, say investigation dey go on

Wia dis foto come from, Getty Images
South Africa police watchdog, Independent Police Investigative Directorate (Ipid) say dem don begin investigate di case against police officers for Pretoria, afta di murder of one Nigerian national.
Di South African bodi wey dey investigate police conduct tell BBC on Monday say dem report Iroegbu case give dem last week and say "our investigation dey go on".
Ipid give dis informate afta Nigerian govment allege say dem kill two of dia citizens for South Africa "for time wen foreigners na target" for dia.
One statement from Nigeria foreign ministry tok say according to report, police officers for Tshwane Metro Police kill Emeka Charles Iroegbu for Pretoria on 28 June "using gruesome interrogation techniques".
Di statement wey tok-tok pesin for di ministry, Kimiebi Ebienfa issue on Sunday, add say earlier for 28 April, dis same police officers allegedly kpai anoda Nigerian, Nnaemeka Ekpeyong.
"Im case still dey pend, dem no make any arrest, even though di four officers wey dey involved dey known to di South Africa Police Service (SAPS)," di statement tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di second victim according to di Nigeria foreign ministry na Musa Yuana Joe, Alias Big Joe, wey unidentified attackers kill for front of im shop on di same day for Witibank, Mpumalanga.
Nigeria foreign ministry wey condemn dis killings tok say e "raise questions about deliberate attempts by some elements to wrongfully tag well-meaning, hardworking and respectable Nigerians as criminals".
Di statement add say e also raise questions ontop di general safety of Nigerians plus oda foreigners for South Africa.
Di ministry say dis pattern wey don continue like dis "na clear evidence say security operatives, especially officers of di Tshwane Metro Police get hand inside, wey dey raise question of state responsibility under International Law."
Di incident according to di ministry come for di middle of anti-migrant protest for South Africa, wey don lead to di evacuation of roughly 25,000 citizens from oda African kontris.
Protesters for South Africa dey ask govment to do more to tackle illegal migration.
Dem say foreigners dey take dia jobs and dey follow dem benefit from public services wey neva do dem.
Ipid explain wetin happun to di two Nigerian nationals
Di victims of dis fresh attacks na Emeka Iroegbu and Musa Joe, wey happun few hours to di deadline wey anti-migrant organisations give undocumented foreigners to comot di kontri.
No statements from di Foreign Affairs Department (Department of International Relations and Co-operation don prove claims by Nigerian foreign ministry say di two deaths dey linked to anti-migrant sentiment.
However, Ipid explain say di circumstances wey lead to di death of Emeka Iroegbu neva dey clear. But according to tori, e die during "some kain gbasgbos wit di police".
Di ministry say dem no go release di details of di complaint, however, dem fit confam say dem don begin torchlight di mata.
On di death of Big Joe, wey also happun on 28 June, Mpumalanga Provincial police confam say unknown armed attacker confront am for front of im salon for eMalahleni, formerly Witbank and shoot am several times, bifor dem run comot di scene for white sedan car.
Police tell BBC say dem neva make any arrest and di motive for di attack neva dey clear.
Police say make anyone wit information wey fit lead to arrest come forward.
Anoda batch of Nigerians go leave South Africa on Tuesday
Meanwhile, Nigeria govment say anoda batch of Nigerians dey expected to leave South Africa on Tuesday, 7 July.
Di Minister of Foreign Affairs, Bianca Odumegwu-Ojukwu, announce di informate for one statement on her official X handle on Monday morning.
"Anoda evacuation flight go leave for Johannesburg tomorrow, Tuesday, 7th July, to bring home our citizens," Odumegwu-Ojukwu write.
Di evacuation go be di latest for di repatriation exercise wey Nigerian authorities dey carry out to ensure di safety of dia citizens for South Africa.
Di minister tok say di last flight for di evacuation dey "expected to land for South Africa on 10th July".
"Our Nationals again dey advised to weigh di risks weda dem wan remain or return," she tok.
' We dey call for investigation' - Nigerian govment
Di minister, wey condemn di killings of di two Nigerians for South Africa, don call on authorities to "urgently investigate di incidents and bring di pipo wey dey responsible to justice".
"Signs no dey say di situation go improve," she tok.
"Nigeria remain concerned about di safety of dia citizens for South Africa as a result of di ongoing xenophobic protests and attacks on migrants, and even more so following di deaths of two Nigerians, Musa Yunana Joe and Charles Iroegbu, during dis unfortunate events," she add.
Earlier, Nigerian govment bin tok say e dey unfair to target foreigners and use dem as scapegoats of endemic socio-economic conditions wey di authorities need to address.
Anoda tin wey Nigerian govment dey para about for South Africa na di recently televised public statement by di tok-tok pesin of di South African govment wia she as Nigerians wey dey comot from di kontri sake of di ongoing xenophobic protests to show wia dem hide illegal drugs.
Nigeria authorities describe am as "unguarded public statements wey dey unacceptable and dey strongly condemned".









