266 more Nigerians arrive from South Africa as evacuation continue sake of anti-immigration protests

Anoda batch of 266 more Nigerians don touchdown di Murtala Muhammed Airport, Lagos dis Friday morning from South Africa, as di Nigerian govment continue to evacuate dia citizens sake of anti-immigration protests wey dey go on for di kontri.
Nigeria foreign ministry tok-tok pesin, Kimiebi Imomotimi Ebienfa, tell di BBC say 266 returnees arrive for Lagos at about 10:40am local time.
Officials say further flights dey scheduled for 6 and 9 July as di exercise dey continue.
Protesters for South Africa bin give African Immigrants for di kontri until 30 June 2026 to go back to dia kontris, sake of accuse say na dem dey behind di rising crime, drug business and unemployment for South Africa.
Di protests don also lead to di death of several nationals of different African kontris, including one Ghanaian wey di Ghana govment tok say dem kill am on dat 30 June deadline day, even though di South African govment don deny di date and circumstances around di killing wey Ghanaian govment release.
Friday evacuation flight go be di fourth batch of pipo wey dey run comot from South Africa.
Di first batch of 268 pipo bin arrive Nigeria on 11 June 2026 through Air Peace, while on 24 June, di second batch of 66 pipo arrive via South African Airways facilitated by one good-spirited Nigerian, and on 30 June di third batch of 269 pipo arrive.
"Three additional flights go dey operated in di next few days to make sure say evri Nigerian wey voluntarily register to dey evacuated, and wey we don screen and clear, go come back safely to di kontri," Kimiebi Ebienfa, di tok-tok pesin for di Ministry of Foreign Affairs tok for one statement on Thursday.
Di Ministry tok say lie-lie tori don dey fly around say some of di Nigerian missions bin dey request money bifor dem go put pipo name for di list of evacuation.
"Dat na totally false, fake news, and pipo no suppose send am," Ebienfa tok for di statement.
Earlier in di week, di Foreign Affairs Ministry tell di BBC say dem go consider demand for compensation from di South African govment, for many Nigerians wey abandon dia valued property and livelihoods in order to save dia lives.









