How first timers Cape Verde shine to save Africa face for di World Cup

Published
Read am in 3 mins

Cape Verde wey be one of di African teams for di 2026 Fifa World Cup win di heart of football fans for dia Round of 32 Fifa World Cup match wit Argentina.

Di Blue Sharks lose 3-2 to Argentina but no be scoreline be di talking point.

Cape Verde wey dey participate for di World Cup for di first time, make World and defending Champions Argentina struggle throughout di match.

Cape Verde do Argentina strong tin sotay dem drag di match reach extra time bifor Argentina win dem sake of own goal.

Argentina qualify for di Round of 16 while Cape Verde join oda African kontris wey comot for di knockout stage.

Anoda African team Ghana crash out of di 2026 Fifa World Cup afta dem lose 1-0 to Columbia wey also progress to di Round of 16. Ghana no see any goal score for di full 90 minutes.

As e be so na only Egypt wey beat Australia 4-2 on penalties afta dem play 1-1 draw and Morocco wey beat Netherlands 4-2 on penalities afta anoda 1-1 draw on Tuesday qualify for di Round of 16.

Wen ten African kontris qualify for di Round of 32 pipo bin dey hope say at least half of dem fit progress to di Round of 16 but e no happun like dat.

Cape Verde Coach Vozinha show imsef well-well as e no leg Argentina score am anyhow.

Di full Argentina team wey dey filled up wit professionals and big names like Lionel Messi play Cape Verde for half field. Cape Verde defence strong as dem dey block evri shot.

Fifa World record holder and di current highest goalscorer Lionel Messi manage score di first goal for di first half on di 29th minute.

Cape Verde player Deroy Duarte score di equaliser for di 56th minute.

Argentina find second goal sotay e enta extra time bifor Lisandro Martinez score dia second goal for 92 minutes of extra time.

Cape Verde no gree to as Sidny Cabral score for di103rd minute.

Pressure too much for Cape Verde as Diney Borges score own goal for di 111th minute to give Argentina di win.

Dis na di only match for dis World Cup wey Cape Verde concede goals.

Cape Verde also make history as di first and smallest kontri wey come di World Cup for di first time kon reach di knockout stage.

African kontris wey don comot from di World Cup

Tunisia

Algeria

Senegal

Ivory Coast

DR Congo

Cape Verde

Ghana

South Africa