You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Colombia sama Ghana 1-0 to qualify for World Cup Round of 16
Ghana be di latest African kontri to comot for di 2026 Fifa World cup afta dia 1-0 disappointing defeat to Colombia.
Di Black Stars enta di game wit plenti confidence afta dia performance against Panama and England for di group stage when dem bin keep two clean sheets.
But for dia R32 match wit Colombia, Ghana no play anytin for di full 90 minutes wey dem comot.
Colombia dominate di game from di beginning to di end wey dem get plenti chances to score more goals.
Ghana goalkeeper Lawrence Ati-Zigi add to di long list of keepers wey dey shine for dis tournament as im make seven saves for di gave.
Di scoreline fit end 4-0 or even 5-0 bifor, if not for di Ghana keeper wey save im team many times when im deny Luiz Diaz, Luis Suarez and di rest of di Colombian attack.
Two early subs for Ghana and Colombia sake of injury scata di formation of di two teams.
Colombia striker Jhon Cordoba bin hurt for di first five minutes of di game wey dem comot am for di ninth minute.
Sporting Club striker Luis Suarez enta di game to replace am wey im provide di assist for Jhon Arias for di Colombia goal for di 14th minute.
Marvin Senaya di right back for Ghana also bin pick up injury wey dem comot am for di 13th minute; Alidu Seidu bin replace am.
From dat point, Colombia control di game wey dem prevent Ghana from creating any chances for di whole game.
Ghana bin carry dia fast wingers Fatawu Issahaku and Ernest Nuamah enta di game to try and find di goal but dem no fit do am.
For di end, Colombia get eight shots on target, eight shots off target wey dem get 61% possession.
Ghana keeper Ati-Zigi bin make seven saves to keep di scoreline respectable.
Coach Carlos Queiroz say dis na "disappointing result, but on di day, di Colombia team bin play beta wey dem dey fit pass us."
"I tink di best team win dis game. We go again next four years wey we go dey hia to represent."
Ghana now join seven oda African kontris to comot di competition.
Tunisia, South Africa, Senegal, Algeria, DR Congo, Ivory Coast all comot di competition togeda wit Cape Verde wey put up excellent performance against Argentina even though dem lose 3-2 for di end.
Cape Verde for dat match hold di World Champions boot-for-boot wey dem score two brilliant goals to push di game to extra time bifor Argentina bin find di winner for extra time.
Di only two Africa kontris wey remain for di competition for di R16 na Morocco wey go jam wit host nation Canada and Egypt wey go jam wit Argentina.
Colombia go also jam wit Switzerland for diR16.