You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Three Nigerians killed in four days' - Nigeria govment react to death of citizens for South Africa
Nigeria consulate forJohannesburg don allege say three more Nigerians die for South Africa within four days as xenophobic tension kontinue to rise against foreigners for di kontri.
Di Nigeria Consul-General to South-Africa, Ninikanwa Okey-Uche, condemn di killings of Nigerians wey happun less dan one week, between 18 and 21 September.
Earlier in September, Nigeria govment bin warn against xenophobic attacks against Nigerians for South Africa, afta dem kill two Nigerians Bishop Taiwo Michael Fakunle and Mr James Uchechukwu for South Africa.
Nigeria govment tell di South African govment say dem no dey happy at all ova di attacks but di South Africa Independent Police Investigative Directorate (IPID) tok say dem go investigate di matta but dem neva still report dia findings to di public.
How di three Nigerians wey kpai for SA
On Monday, Nigeria consulate for Johannesburg inside dia statement allege say di first victim wey be Kenechukwu Christopher Igwemmadu die as e dey try run from 'police harrasment and brutality for Kenlin Court on Douglas street, Central Business District (CBD), Bloemfontein.'
Nigeria consulate also allege say one 'South African national kill anoda Nigerian Olaniyi Olaleye Olatunde for Spanata Bar and Grills Nights Club for Pretoria 'afta im try stop di South African wey wan carry di club cup comot.'
Naso dis cause gbege, di South African carry gun shoot Olatunde.
"For 18th September 2026, one Nigerian pesin, Kenechukwu Christopher Igwemmadu, allegedly jump to death while e dey run from police harrasment and brutality for Kenlin Court on Douglas street, Central Business District (CBD), Bloemfontein," di statement tok.
"Di incident start wen di deceased, wey dey work as Security Guard for di Club for Summer Event Centre for Mamelodi, try stop one South African customer wey wan carry cup wey belong to di club comot."
"Dis result in gbege and di South African bring out im gun and shoot Olatunde for im lower body, e suffer serious injury and e begin bleed heavily."
Nigerian consulate also demand for justices ova di death of two Nigerians wey mobs by South African politician and content creator (Sizok'thola team), Xolani Khumalo kpai.
'But authorities for South Africa neva make any arrest.'
Also anoda Nigerian, Christian Hillary Nnaemeka die afta mobs alledgedly by Sizok'thola team, wey Xolani Khumalo dey lead, gada to torture and 'kill di Nigerian man.'
"Di crew arrest am, beat am and torture am bifor e try to run away by jumping ova di fence. Afta dat, e collapse from di injury and tiredness, wen dem rush am go hospital, dem declare am dead wen e reach dia."
"You go rememba say on 9th February 2026, anoda Nigeria guy, Emeka Clement Uzor, Xolani Khumalo reality TV crew shoot am for Windsor East, Randburg. Yet, no arrest don happun and Xolani KHUMALO dey run for election to be di Mayor of Ekurhuleni."
Nigerian and all lives matter -Nigeria consulate for Johannesburg
Nigeria consulate for Johannesburg don ask South Africa make dem make sure say Nigerians and oda foreign nationals dey safe in di kontri as dia position remain say "NIGERIAN AND ALL LIVES MATTER".
Nigeria govment tok say di continuous repetition of dis incident come be like say na 'pattern to target Nigerians for South Africa.'
"On dis matter, we go continue to dey call on di South African authorities to investigate di deaths throoughly and bring di people wey commit dis gruesome act to justice. Our position remain say NIGERIAN AND ALL LIVES MATTER."
"If any allegation dey, no matter wetin di allegations, dem suppose follow due process to get justice. Evribodi suppose dey innocent and make dem get fair hearing for court. No one suppose take law into im own hand."
Nigeria govment don ask Nigerians for South Africa make dem 'remain calm, law-abiding and security conscious in di midst of di ongoing xenophobic/afrophobic attacks, threats of attacks, general insecurity and ill-treatment wey dey happun among black African foreigners for South Africa, especially Nigerians.'
Di Nigeria consulate for Johannesburg don extend dia deepest condolences to di families of di three pipo wey die
"As we pray for dia souls to rest in peace, we go continue to fulfil our mandate of overseeing di welfare and fair treatment of all Nigerians for di kontri."
September 30 deadline for undocumented migrants for South Africa
Dis latest Nigeria reaction dey come days bifor 30 September deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to go back to dia own kontris.
Dem bin set similar deadline for 30 June. Thousands of pipo bin take part for di anti-immigration protests around di kontri, wey result in some incidents of violence and looting. Police say about 900 pipo bin chop arrest, mostly for immigration-related offences and looting.
South African authorities don stress say immigration enforcement na di responsibility of di govment and dem cut warning against vigilantism and attacks on foreign nationals.
Nigeria no be di only kontri wey dey help dia citizens to leave South Africa as Malawi say dem don bring home more dan 38,000 citizens between June and early July, while Zimbabwe don report di return of more dan 21,000 pipo.
Di Nigerian govment dey ask South Africa to act on dis matta and arrest all di pipo wey get hand for dis killings.
Cyril Ramaphosa tok on xenophobic attacks for South Africa
South African president, Cyril Ramaphosa don tok say South Africa no suppose dey defined by xenophobia and intolerance.
Ramaphosa tok say e dey irresponsible for any South-Africa to dey make "inflammatory statements" wey go fuel social tensions among foreign nationals.
But e also add say any migration wey go happun for South Africa gatz happun within di law and dose wey wan live for di kontri must respect di law.
"At di same time, migration must take place within di law. Govment get responsibility to manage our borders effectively, and everybody wey dey live for South Africa suppose respect our laws," Ramaphosa tok.
Timelines of Nigerians wey don die for South Africa in 2026
- For February 2026: Dem kill Emeza Uzor for Ekurhuleni in South Africa.
- For April 2026: Tshwane Metro Police kill Nnaemeka Ekpenyong for Pretoria in South Africa.
- June 2026: Two Nigerians die during anti-migrant protest, Tshwane Metro Police for Pretoria torture Emeka Charles Iroegbu, while Musa Yunana Joe (Big Joe) die afta some mobs attack am in front of im shop for Witibank, Mpumalanga in South Africa.
- For September 2026: Dem kill five Nigerians including Bishop Taiwo Michael Fakunle and Mr James Uchechukwu wey dem kill for September 4 for South Africa and Kenechukwu Christopher Igwemmadu, Olaniyi Olaleye Olatunde and Christian Hillary Nnaemeka wey die between 18 and 21st of September.