Nigeria condemn alleged killing of two citizens for South Africa, call for investigation

Published
Read am in 4 mins

Di alleged death of two Nigerian nationals for South Africa don dey cause tok-tok for di kontri.

Belle no sweet Nigeria govment wey don chook mouth for di mata as dem condemn di action wey allegedly kpai di two pipo.

For statement wey tok-tok pesin for di Ministry of Foreign Affairs Imomotimi Ebienfa release on Sunday 5 July, 2026, Nigeria govment identify di two victims as Mr Emeka Charles Ibegbeu and Nnaemeka Mathew Andrew Ekepynong.

According to di statement, officers of di Tshwane Metro Police allegedly kill Oga Emeka on 28th June, 2026, for Sunnyside, Pretoria, afta " dem use gruesome interrogation technique."

Di same officers bin allegedly dey responsible for di extra-judicial killing of anoda Nigerian Mr Nnaemeka Matthew Andrew Ekepynong" on April 20.

South African authorities neva comment on these allegations.

Nigerian govment say dem dey "deeply concerned" by di two deaths, and add say e come "at a time wen dem dey target foreigners for South Africa".

Anoda victim na, Mr. Musa Yanua Joe, wey pipo sabi well-well as Big Joe.

According to di statement from di Nigeria Ministry of Foreign Affairs, dem allegedly kpai Big Joe for front of im chop on 28th June, 2026, for Witbank, Mpumalanga.

Nigeria govent dey para well-well say sake of say authorities neva fit identify di jaguda pipo wey kpai dis pesin and commit crime.

E dey also make Nigeria govment vex well-well sake of say dis two killings happun wen time dem dey target foreigners for South Africa.

"E dey raise questions about deliberate attempts by some elements to wrongfully generalise and tag well-meaning, hard-working, and respectable Nigerians as criminals. E dey also raises further questions over di general safety of Nigerians and oda foreigners for South Africa."

Nigeria govment tok say dis pattern wey dey continue like dis "na clear evidence say security operatives, especially officers of di Tshwane Metro Police get hand inside wey dey raise question of state responsibility under International Law." "Data wey Nigeria missions put togeda lay di grounds of criminal liability. Na fact say South Africa currently get di highest rates of crime globally, including di culture of looting and mob action.

Nigerians dey more civil for our engagements wit foreign nationals, and we dey always uphold di rule of law wen we dey dealing with illegalities.

So far di case still dey pending; dem neva arrest anybody, even though di South African Police (SAPS) sabi di four officers wey allegedly get hand for di mata.

' We dey call for investigation'

Authorities for di West African kontri tok say e dey unfair to target foreigners and make d no use dem as scapegoats of endemic socio-economic conditions wey di authorities need to address.

Anoda tin wey Nigeria govment dey para about for South Africa na di recently televised public statement wey di tok-tok spokesperson of di South African govment tok wen im bin dey ask Nigerians wey dey comot from di kontri sake of di ongoing xenophobic protests to show wia dem hide illegal drugs.

Nigeria authorities describe am as "unguarded public statements wey dey unacceptable and dey strongly condemned."Nigeria authorities don tell South African authorities to conduct urgent investigations into di two killings and oda plenti pending cases of extra-judicial killings of Nigerian nationals for South Africa.

Dem dey call for justice so dat di criminals go face di law. " We dey place di govment of South Africa on notice say if di situation continue, all options wey remain for di table, dem go activate am."

Nigeria govment don advise dia citizens for South Africa to dey calm, obey local laws and avoid areas affected by ongoing anti-immigration demonstrations as diplomatic engagement continue.

Dem say dem go continue to dey relocate dia citizens. Dem don bring back more dan 700 nationals in four batches, wit two more flights scheduled for 6 and 9 July.

South African authorities neva publicly respond to di latest statement from Nigeria.