You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria university expel students ova accuse of gay practice
Di management of Confluence University of Science and Technology (CUSTECH) for Osara, Kogi state, northcentral Nigeria don approve di expulsion of two students on top accuse say dem dey practice gay.
Dem also suspend four oda students for one academic session sake of say dem fight for campus.
Di school management wey announce di informate for statement on Friday, 24 August, tok say dem approve di disciplinary measures for di 31st Regular Meeting of di University Senate afta dem consider recommendations from di Students' Disciplinary Committee.
Di Deputy Registrar Academics Eli Gbadafu for letters wey e address to di affected students say di institution take di disciplinary actions in accordance wit di provisions of di Students' Handbook, Second Edition, as amended in 2025.
Di University name di students wey dem expel as Onumoko Hamza and Abdulazeez Eneji. One of dem dey study Biology Education and di oda Mining Engineering.
Di students wey dem also suspend for fighting na females for di department of of Biochemistry, Biology and Microbiology.
Management warn say dem no go hesitate to take decisive disciplinary action against any student dem guilty of violating di rules and regulations of di university.
"Students are therefore advised to familiarise demsefs wit di provisions of di Students' Handbook and conduct demsefs in accordance wit di established rules and regulations of di university, di statement add.
End of Di one wey oda users dey read well well
Homosexual acts dey illegal for Nigeria. Same-sex couples fit face up to 14 years in prison.
Di law also recommend prison sentences of up to 10 years for anyone wey follow for gay clubs or organisations and for same-sex couples wey publicly show affection.