How Hisbah gbab youths wey allegedly dey swap wives for Bauchi

Wia dis foto come from, Getty Images
Hisba Command for Azare, Katagum Local Govment Area of Bauchi State, tok say dem don arrest and detain seven men wey dem suspect say dem dey exchange dia wives among demsefs.
Di commander of the Hisba for di area, Malam Ridwan Muhammad Khairan, wey tell BBC Hausa, say dem make di arrest based on suspicion say dem commit crime wey neva happun bifor.
Hisba tok say wetin di youths dey do go against Islamic teachings wey join evri woman to one man.
Current affairs analysts for Bauchi don praise di raids wey Hisbah launch to arrest di suspects, and tok say if dem leave di situation like dat, e fit spread to oda places.
Reason dem dey swap wives
Di seven pipo wey Hisbah arrest, dem suspect say dem be members of one group wey dem dey call Wuddadu.
Dem tok say di pipo wey dey swap dia wives make dia agreement based on one dream wey one of dem get about exchanging dia wives.
"One of dem, Muhammad Awwal, confam to us say na from dream e get dis knowledge, say e dream about one prophet and na why dem convince dia wives make dem do dis act," na wetin Malam Ridwani Muhammad Khairan, di head of the Hisbah board for Katagum zone for Bauchi state, tok.
How dem get exposed
Malam Ridwani Muhammad Khairan, wey be head of Hisbah board for Katagum zone for Bauchi State, for one video wey dey circulate for social media, tok say di mata of pipo wey dey swap dia wives don dey happun for two years for Azare town witout anybodi knowing.
E tell BBC Hausa say as e don too much, one of di women wey dem dey swap kon expose di secret.
"One of di women tok say she no fit continue dis kain act, na im make am leave dem", e tok and add say na she make di secret begin come out.
From dia, some leaders of Wuddadu group kon get di information and dem warn di seven pipo say wetin dem dey do dey against Islamic teachings and even dia group teachings, but dem refuse to stop.
"One group wey dem dey call Kuddadu gather come meet me say some pipo among dem bring one teaching wey dem no agree wit… we kon invite di pipo, sit down wit dem, and dem confam wetin dem accuse dem of…," e tok.
Wetin be di group dem dey call Wuddadu?
Di group wey dem dey call Wuddadun Nabiy, na part of Tijjaniyya Sufi order wey dey build closeness to God through spiritual purification and asceticism.
Like oda Islamic groups, Wuddadu sef recognise say some pipo among dem don go too far, and di group feel say dem must take action against dem.
"At first, di leader of di Wuddadu group start to beg di deviants among dem wey dey spread dis corruption but dem no gree hear. Na im make di leaders of di group rush go Hisbah to report wetin dey happun," Leadership newspaper report.










