Trump fit release US-Iran deal bifor Friday, Vance tok - wetin dey inside am?

Published
Read am in 5 mins

Donald Trump fit decide to release preliminary deal to end di war wit Iran bifor Friday, US Vice-President JD Vance tok afta di US president say di agreement don already dey signed.

Vance bin describe di memorandum of understanding (MOU) between di US and Iran as "about a page and a half" and a "veri general" document.

Senior US officials don also start to give some details about di deal, as dem brief say di Strait of Hormuz go dey re-open on Friday - di same day dem go formally put ink ontop di deal for Geneva.

Iran Foreign Minister Seyed Abbas Araghchi confam say new round of negotiations on reaching final peace deal wit di US go begin for Switzerland di same day.

Dis dey come up as Trump attend di G7 summit for France on Tuesday. Di summit go host special session about Iran. Leaders from Egypt, Qatar and United Arab Emirate go attend.

Afta tok-tok wit French President Emmanuel Macron on monday, Trump say "I dey happy say e don dey signed, di deal don dey signed", e dey refer to di preliminary agreement.

US officials say Trump, Vance and Iran parliamentary speaker Bagher Ghalibaf don sign am electronically.

Vance tell NBC say dem dey expect say dem go allow nuclear inspectors back into Iran as part of di deal.

"One of di core parts of di agreement be say di (International Atomic Energy Agency) and di United States go help Iran destroy 'highly enriched stockpile' - dis na one tin dem spell out clearly.

Vance bin don tell CNN staff Jake Tapper say di MOU na general document, say dem go work on plenti oda details during dia future negotiations.

E say "most importantly be say Iran go get verifiable commitment say dem no go build anoda nuclear weapon.

Iran and US don dey fight war since February 2026 wen US and Israel strike Iran. Iran respond by striking Israel and US ally states for di gulf region. Di war don consume plenti casualties.

Sake of di war, Iran close di Straight of Hormuz wey lead to rise in oil prices all ova di world. Di area na one of di busiest shipping channels for di whole world.

Wetin dey inside di deal

US President Donald Trump confam say "di deal wit di Islamic Republic of Iran don complete", say part of di agreement be say dem go open di Strait of Hormuz "make di oil flow", na wetin e post for social media.

Trump say e don order immediate removal of one US naval blockade for Iran port.

Iran Deputy Foreign Minister confam for live TV say true true dem don agree deal to end di war.

Some top military commanders dey hail di deal, say na victory for Tehran.

Pakistan Prime Minister Shebbaz Sharif say di two warring kontris don agree to do immediate termination of military operations on all fronts.

Tori be say di target na to extend di ceasefire wey dem agree for April make e reach more 60 days.

Anoda tori be say di deal get 14 points memorandum of understanding between di two kontris.

As at di time of publishing dis piece, di two kontris neva announce di specific points wey dey inside di deal.

For congratulatory joint statement, leaders of UK, France, Germany and Italy say Iran "must not acquire nuclear weapon", say dem dey ready to lift sanctions in response if Iran show clear and verified steps about dia nuclear programme.

US Vice President JD Vance for interview for Sunday evening tell Fox News say part of wetin dey di agreement na make Iran no get nuclear weapon and say US go get access to verify am.

For decades, Iran dey accused by Western kontris of trying to build nuclear weapon.

Dem deny di accusations and say dia programme na for peaceful purposes - to generate electricity and for research purposes.

Meanwhile, Israel don tok say di deal announcement no concern dia occupation of Lebanon.

Israel dey occupy 5% of Lebanon territory and don send air strikes and do demolition for one village dia.

Israel and Hezbollah bin agree ceasefire for 2024 but Israel still dey attack targets almost evri day.

President Trump tell Wall Street Journal on Sunday say im dey vex for Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu say e order strikes on Lebanon last weekend, say dat strike fit scata di deal wit Iran wey dem don almost complete.

Israel say dem jump dia head to make di deal.