Authorities declare 'Ghana Jollof' wanted ova Tiktok page inciting violence

Woman looking at di camera straight wit curly hair

Wia dis foto come from, Ghana Police/Facebook

Published
Read am in 6 mins

Security authorities for Ghana don dey find di pesin wey dey behind one tiktok account wit di name 'Ghana Jollof'.

Dem accuse say di account dey allegedly incite violence, attacking di govment and plotting coup d'état.

Ghana police don declare one Barbara Asantewaa Kodua wey dem accuse say na she dey behind di 'Ghana Jollof' account.

Police say di 40-year-old woman dey 'last seen for Accra International Airport for 4 August 2022.' and dem believe say she dey 'UK wia she dey hide'.

Di social media account for many months bin dey post about di President John Mahama, im wife Lordina Mahama and heads of di kontris security agencies.

Inside many videos wey BBC News Pidgin don watch on top di Tiktok page, one female voice dey incite pipo wia she dey use different words against di First Lady and oda female govment appointees.

For some videos, di voice behind di account accuse di First Lady of 'infidelity' wey also accuse di president say im 'dey sleep wit plenti women and young girls.'

Di voice for di videos also bin call di security agencies for Ghana say dem no fit find her.

Dis na how di matta begin trend wey make authorities begin to pursue di face wey dey behind di account.

Dem arrest one nurse wey dem say she dey connected to dis account

Authorities bin pick up one nurse – Salomey Baffoe for Techiman for di Bono East Region ova di weekend in connection wit dis case.

Local media media JoyNews bin report say some uniform men bin storm di house wey dem say dem be national security operatives.

Relatives of di nurse say di uniform men bin carry Salomey comot di house dat night wey dem neva see her since.

According to di family, di security operatives accuse dem say dem sabi sometin about di 'Ghana Jollof' Tiktok account and di tins di account bin dey post.

"Dem call me for phone wey dem tok say I be di mama of 'Ghana Jollof', na so dem come dis house – but I no sabi anytin, my pikin no be di Ghana jollof pesin, me too I no be 'Ghana Jollof', I no sabi wia dem carry my daughter go," mama of di nurse wey chop arrest bin tok to JoyNews.

Bifor di arrest, di photo of di 40-year-old nurse bin circulate online as di face behind di 'Ghana Jollof' page.

But Salomey Baffoe bin do video wey she tok say she no be di one and she no be politician.

"I see say some pipo put my picture for Tiktok say na me be 'Ghana Jollof'. I beg evrione, no be me. I no sabi dis pesin, I no be politician, somebody don dey impersonate me," she tok inside one video disclaimer days bifor dem arrest her.

Di family say na mistaken identity even though security agencies believe say she dey linked to di social media account.

One opposition lawmaker wey dey follow di case - Nana Agyei Baffour Awuah raise questions about di arrest and detention of di 40-year-old nurse.

"If you pick up pesin from dia house since Sunday wia di family no sabi wia dia relative dey, dat one be abduction, no be arrest anymore."

E tok say police for court tell di judge say di nurse bin dey work wit di 'Ghana Jollof' page to cause kasala for di kontri.

"Dem say dem bin still dey keep Salomey for custody sake of she don dey work wit di pesin wey get di 'Ghana Jollof' page, to plan to comot di president, dat be wetin dem tell di judge," oga Agyei Baffour Awuah tok.

E no dey clear at dis time wetin di police bin present as details of di case for court, but sabi pipo say dis be anoda "unfortunate development" for di kontri.

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

opposition party lawyers say di detention of di nurse be illegal

Wia dis foto come from, GHANA JOLLOF SCREENGRAB

Wetin we call dis foto, Di Police don declare one Barbara Asantewaa Kodua wey dey behind di Ghana Jollof page wanted

Ghana Registered nurses and midwives association react

Inside one statement, di Ghana Registered Nurses and midwives association (GRNMA) say dem send delegation to di police CID to understand di circumstances surrounding di arrest of dia member wey dem reportedly link to di 'Ghana Jollof' investigation.

Dem confam say Police for di CID Headquarters bin tok dem say dia member – Salomey Baffoe – dey for police custody.

"Police say sake of di sensitive nature for dis case and di ongoing investigation, we no fit give specific details, but we fit contact di lawyers wey represent her for court for 16 September," tok-tok pesin for di Registered Nurses and midwives association oga Philimon Gyapong explain.

Di association say dem no dey happy wit di way security agencies bin dey handle di matter without "transparency".

Di nurses and midwives association say dem dey in contact wit di family of dia member wey bin dey face dis charges.

"We dey extend our solidarity wit di family wey we dey assure dem say di association go provide legal, emotional and institutional support to her for dis hard time," di statement tok.

Di court on 17 September don remand Salomey for two weeks as police continue to investigate.

Di judge say di case gat "national security implications."

One of di lawyers bin ask "you say you find say di pesin wey dey operate di Ghana Jollof page bin dey for UK, so why you dey keep dis nurse for custody?"

Image of wanted pesin

Wia dis foto come from, Ghana Police/Facebook

Di 'Ghana Jollof' tiktok page still dey post content

BBC News Pidgin no fit independently establish di connection between dis 'Ghana Jollof' page and di nurse wey chop arrest.

Tori bin dey say police don arrest at least two oda women wey dem suspect say na dem dey operate di controversial page.

We bin reach out to di Ghana Police for comments and more details for dis mata but dem no provide di information at dis time.

Di 'Ghana Jollof Tiktok page get almost 160k followers wia get profile of opposition new Patriotic Party (NPP) 2028 campaign poster.

As at 8AM (GMT) on Thursday 17 September, di account post anoda video wit di picture of di president and di Police CID boss Lydia Donkor.

Di voice for di video dey attack Ghana First Lady togeda wit di president and di CID boss.

Dis no be di first time authorities bin dey pursue social media accounts wey bin dey publish "offensive and abusive" content.

For July dis year, di court jail one Tiktoker Camilla Alhassan for on year wit hard labour afta she bin plead guilty to offensive conduct and publication of false news.

Camilla don dey post content for her Tiktok page wey dey attack and insult di president and di first lady wey she bin accuse di first family of many tins including murder and rape.

At least three oda pipo bin dey di net of di police afta dem also use dia social media page especially Tiktok to post abusive and offensive content about public officials.

Sabi pipo and oda critics togeda wit di opposition say dis clampdown na to silence dissent and freedom of speech, but di govment say na to protect di kontris national security.